Nor be small shege Congo dey see, today Ebola tomorrow askident.
Water just swallow one boat for Lake Tanganyika for Democratic Republic of Congo, kpai kpai at least 41 pipo, while 49 pipo manage escape.
Dis latest badness for Congo don dey make pipu dey ask whether, spiritual problem Congo dey face so, as dia village pipu nor wan allow anybody rest for bad news.
According to gbeboro doings, say dis boat go carry overload, 100 passengers plus heavy-heavy cargo say dem dey travel from Tanzania go Kalemie.
Provincial transport minister, Norris Mulongoyi, Naim konfamate dis badness, say, like dis rescue team dey inside water like fish, dey still find who dem go rescue.