By: Mariam Ajayi
UNHCR don warn on Tuesday, say nearly 8.3 million refugees and other pipo wey force comot dia homes fit lose important support because serious shortage of money dey affect di agency.
United Nations refugee agency say di money wey dem get to protect and help refugees, internally displaced people and people without nationality don drop from 5.2 billion dollars for 2024 to 3.9 billion dollars for 2025.
Di agency say e need 8.5 billion dollars dis year to support refugees, but by end of July, na only 32 percent, wey be 2.7 billion dollars, dem don receive.
UNHCR warn say continued cuts for funding don push refugee support and protection systems close to breaking point for major displacement areas around di world