By: Mariam Ajayi
ADC candidate for Eti-Osa Constituency II, Ayodele Adio, don clear NEPA bills wey pipo owe for one community wey no get light tey tey.
Adio make di move during im visit with community leaders and NEPA officials on Wednesday, as residents celebrate when power return to di community.
But residents later complain say light don go off again after one alleged instruction to NEPA to disconnect am, though e never clear who give di instruction, while Adio dey also push for better housing, waste management and oda community needs.