Catholic priest, Father Patricio Sánchez Molinari, don kapi after one big wooden cross wey dey hang behind am for altar fall ontop im head as e dey celebrate Mass for Our Lady of Perpetual Help Church for Guayaquil, Ecuador.
Di askident happen on Saturday as dem dey livestream di church service for social media.
According to AP report, di priest no be like say e notice when di cross dey fall, as worshippers dey shout for help while di livestream still dey continue.
Di worshippers try hellep di priest as dem dey shout make dem bring ambulance.
Di newspaper, El Universo, report say di priest don serve for several years for San Lorenzo de Vinces parish before im death, and di church community don mourn am.
As at di time dem publish di report, authorities never officially konfamate wetin make di cross detach from di wall fall ontop di priest.