By: Kofoworola Olayinka
Di Arewa Consultative Forum don urge Federal Gorment to admit say e miscalculate di impact of economic reforms on Naija pipu and set timeto improve dia living conditions.
Di Forum Publicity Secretary, Professor Tukur Mohammed-Baba, tuk dis as e point to rising cost of food, rent, transportation, electricity and insecurity as signs of di hardship wey Naija dey face.
Mohammed-Baba say gorment suppose introduce measures within three months to reduce pipu suffering, and explain how e go improve di standard of living.
On di 2027 general elections, di ACF spokesman say di Forum go support political parties and candidates wey demonstrate commitment to good gofnance, accountability, anti-corruption, fairness and equity.