Entertainment

Adunni Ade Shock Fans Show Her Two-Year-Old Pikin To Di Public

todayJune 8, 2026 5

Background
share close

By : Jolayemi Olajide

Actress Adunni Ade don scat social media after she use her birthday take tuk say she get one baby girl wey she hide for low-key for two years.

Di movie star say she intentionally keep Baby Sal away from public eye because she want to guard her peace and enjoy motherhood without social media drama.

She fry mouth say her family peace dey very importankpa, warning pipo make dem stop to think say every single mother get scandal.

Adunni con describe di baby girl as her answered prayer and real proof say God dey bless person when the correct time reach.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds