Entertainment

Advanced Metastatic Kidney Cancer: “Wetin Alexx Ekubo Death Teach Us About Our Health”

todayMay 25, 2026 5

Background
share close

One kain heavy silence dey always enter house anytime sickness land, di laugh wey dey burst everywhere go begin reduce, pipo go dey talk low-low, plans and dreams wey dey fly high go begin drag leg, even money wey plenty reach mountain go suddenly look like ordinary paper.

For dis life, many pipo dey kill body pursue money, dem go wake before cock crow, suffer traffic, skip food, ignore body signals, lock stress inside chest and deny themselves sleep, all because dem wan hammer, but for inside that endless hustle, many pipo dey forget one important truth say na health dey carry wealth for head. Health na di real foundation of life and na di silent engine wey dey drive every achievement, every smile and every dream, di day health break down, everything fit scatter.

A billionaire wey dey struggle to breathe for hospital bed no go mind to throw away millions if e fit buy one more chance to live without pain, for that moment, money no be king again. E go just be ordinary paper wey dey beg time for mercy.

Make we look di case of popular Nollywood actor, Alexx Ekubo, wey reportedly die on May 11, 2026 after complications from advanced metastatic kidney cancer.

Advanced metastatic kidney cancer na kidney cancer wey don spread comot from di kidney enter other parts of the body like lungs, bones and even brain, once e reach that stage, di battle don hard well-well. Reports show say kidney cancer dey become serious wahala for Nigeria and about 1,640 pipo dey suffer am every year, while roughly 938 pipo lose their lives to di disease annually, di painful part be say most patients no dey discover di sickness early.

Between 62% and over 90% of cases, na when the cancer don spread finish and don become dangerous dem dey know wetin dey happen, na why survival rate for kidney cancer patients for Nigeria still dey very low, between 15% and 20%, unlike many developed countries where early detection and better healthcare don help save plenty lives. Many things dey cause dis problem, lack of awareness, poor access to quality healthcare, delay in going to hospital, money problems and lack of proper screening centres all dey add fire to di marras.

For many pipo, signs like blood for urine, constant back pain, unusual tiredness and sudden weight loss dey ignored, some go say na ordinary sickness, some go buy drugs for chemist, some go pray am away, but before dem know wetin dey happen, di sickness don dig root deep inside body.

But for Alexx case, access to treatment and quality healthcare no fit stop di reality of a disease wey don advance too far, because when health matter don reach certain level, wealth go bow.

Di rising number of kidney cancer deaths for Nigeria na serious warning bell for everybody, say health no be something wey person go dey postpone, If you dey ignore symptoms, dey postpone checkups or dey depend only on self-medication, sickness fit dey grow quietly like fire wey dey burn under dry grass until e become disaster.

No amount of money fit buy another life, no amount of success fit comfort person wey sickness don pin for bed.

As you dey hustle for wealth, no forget to protect di body wey dey carry di hustle, because di day health collapse, bank account fit full, but life still fit empty.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds