By: Rilwan Agbomeji
Afenifere, di pan-Yoruba socio-political group, don yarn say dem dey worried about di way terror attacks don increase for Yorubaland and oda parts of Nigeria.
For statement wey dem release for Ibadan, di group publicity secretary, Jare Ajayi, call South-West governors make dem act on di security resolutions wey dem agree on for dia meeting on November 24, 2025.
Recently, gunmen attack forest guards for Old Oyo National Park for Oyo State and kill five National Park Service officers late for night.
Still for di region, dem kill four farmers for Igboho and kidnap one nursing mother with her pikin for Ondo State, matter wey don put serious fear for many communities.