Entertainment

“All dey alright,” Ola Lagos Yarn After Dem Tear Down Im Car Showroom

todayOctober 13, 2025 29

Background
share close

Popular Naija auto dealer and influencer, Ola of Lagos, don confirm say dem don demolish im car showroom, but e still dey positive despite the wahala. For im Instagram story, Ola talk about how im luxury car showroom dem tear down just months after e open, after video wey show the demolition go viral online. Even though nobody talk why dem do am, Ola tell im followers say im car business still dey run well well.

Ola still yan say im dey plan launch new and better showroom wey e name OOL Autos, wey e talk say go big pass before. E write, “OOL Autos new showroom dey come soon… Bigger and better insha Allah. We still dey active! We dey sell cars before showroom and we go still dey.” E thank all di people wey dey support am, talk say e don face many losses wey fit make am give up, but e still dey smile and dey thankful. Ola talk, “Omo, all di calls and messages, thank una, I dey gidigba. I dey smile now. I don dey face losses wey fit buy me house for Ikoyi. Man go just reason, smile, thank God, come motivate people, then continue dey hustle. All is well ooo haha…”

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

Similar posts

Entertainment

Must Read: 2Baba and Annie Break Up Story

By: Kofoworola Olayinka   Sometimes, love fit real, di memories fit sweet, di children fit precious, but somehow, di marriage still fit scatter for ground. Check 2Baba and Annie Idibia tori from start to finish, you go understand wetin we dey yarn for here and why dia breakup pain plenty […]

todayAugust 31, 2026 10


WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds