Sport Yarns

American Runner Tell Athletics World Pipo To Beg Amusan Say Dem Doub Her Wrongly

todayMay 27, 2026 4

Background
share close

American runner, Kyle Merber, don drop bombshell say all di pipo wey doubt Tobi Amusan world record for 2022 suppose beg di Nigerian girl.

Naija star Amusan bin set the 100m hurdles world record for 12.12 seconds during di 2022 World Championships, but big names like Michael Johnson tuk dat time say, na breeze cause am dat time.

Dem bin dey complain say track condition, new running shoes, or even jazz  dey inside di mata, dat di time too fast.

But as American athlete Masai Russell just run 12.14 seconds for Xiamen Diamond League, dia eye don clear, everybody don change mouth.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds