Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
By: Rilwan Agbomeji
Di Lagos State Police Command don begin touchlight marras afta one viral video burst online, show how area boys dey manhandle one uniformed police officer over allegation say im go thief.
Di clip, wey circulate on Wednesday, capture di officer as blood dey pour from im mouth as angry area pipo surround am like say dem get am for mind before.
Shege promax just dey whaooo whaooo for di man face and im dey beg for im life, still wear im uniform, while dozens of area pipo raise dia phones dey record di whole drama.
Even as voices for background dey shout say na thief im be, di exact wetin im allegedly steal still no clear as di time wey dem file di report.
Written by: News Editor 1
area boys robbery incident Lagos area boys attack Lagos breaking news police officer assaulted Lagos
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025