By: Esther Ayoola
Former Vice President Atiku Abubakar sef don join dey drag di naija Senate over di way dem handle di Electoral Act mata, say mixing manual and electronic transmission (e go be like rice and ogbonor mixed together,) dat e go make election result drag.
Di senior man yarn dis one afta im visit former military Presido Ibrahim Babangida for Minna with Oyo State Govo, Seyi Makinde.
Atiku tell journalists say Nigerians dey expect correct real-time electronic transmission of election results, and dat na di only Korrect thing to do be dat.