By: Esther Ayoola
Australia don cancel visa for one Israeli influencer, Sammy Yahood, wey dey spread hate against Islam.
Untop post for X, Home Affairs Minister, Tony Burke don make am clear say, make nobodi come Australia con spread hatred.
Wetin di influencer writer, say, Yahood write say Islam no dey tolerate non-believers, women, pikins, and gay people, ni be di probelm.
Australia Gornment like dis don dey tighten hate crime law afta di Bondi Beach mass shooting wey kill 15 people.