Bayelsa Police don arrest one 23-year-old university student wey spread fake social media news say bandits don invade some parts of di state.
Commissioner of Police, Daniel Iyamah, tok dis one on friday for Yenagoa, say di fake report cause serious panic and disturb business and school activities.
According to am, di false story claim say militants catch di bandits and dey demand N50 million ransom before dem go release dem.
Police say investigation show say di report no be true, and dem don arrest di suspect wey create and spread di fake news.