Lagos

Bill To Regulate Craftsmen And Artisan Pass Second Reading

todayAugust 11, 2026 6

Background
share close

By: Kofoworola Olayinka

Lagos State House of Assembly don consider di Lagos State Artisans and Craftsmen Regulation Bill 2025 for second reading.

Di bill, sponsored bye Hon. Adams Nohem, go establish a regulatory board wey go register and monitor artisans and craftsmen for Lagos, so gornment fit get proper record of dem activities.

Lawmakers too support di bill, but dem raise questions about funding, loans and how members go register.

 

Di Speaker, Mudashiru Obasa, say proper database for artisans na important, before e send di bill go House Committee on Commerce and Industry to look am and report back within two weeks.

 

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds