Entertainment

Blessing CEO Drag Nigerians Wey Dey Blame Rita Daniels For Regina Marry Ned Nwoko

todayNovember 5, 2025 49

Background
share close

Relationship expert, Blessing Okoro aka Blessing CEO don drag Nigerians wey dey blame Rita Daniels for allowing her pikin, actress Regina Daniels, marry Ned Nwoko. Since Regina and Ned marital wahala don show online, some people don dey bash Rita Daniels say she allow her pikin enter polygamous marriage with older man. Blessing CEO come defend Rita, talk say plenty children at Regina age fit rebel and no dey hear word from their parents. She ask Nigerians make dem stop dey blame mama, say: “Na the mama naim I blame? Can you shut up! At what age you become rebel? At what age you dey sneak go see man? At what age you get pregnant? We young children dey make poor decisions. Stop all this nonsense.”

Blessing CEO also drag those wey dey mock Regina for lament about her marriage. She talk say Nigerians dey advise women wey dey face wahala for marriage make dem talk out, but if woman finally talk or cry out for help from domestic vi0lence, dem go turn mock am. She share her own story say she self never dey hear word at 15, and even when she decide to marry for University of Calabar, her parents beg her not to marry, but she no gree. Blessing CEO conclude say all dis Regina Daniels gist wey dey trend na example say young people fit make mistakes, and people suppose dey supportive instead of dey judge.

Written by: Jolayemi Olajide

Rate it

Similar posts

Entertainment

Mohbad Family Sti Dey Fight for DNA of Hin Pikin

Di family of late Nigerian singer, Ilerioluwa Aloba, wey everybody know as Mohbad, don demand make dem reveal di name of di US laboratory wey dem wan send di sample go for di DNA test to clear who be di real papa of hin pikin, Liam. Mohbad family still call […]

todayOctober 30, 2026 12


WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds