Blog masonry

Background

Sports

2026 WCQ: Super Eagles Go Fight Till Di Last – Troost-Ekong Talk Am Raw

Super Eagles captain William Troost-Ekong talk say di team go continue to push hard to make sure dem qualify for di 2026 FIFA World Cup, Naija go face Lesotho Crocodiles and dem neighbours Benin Republic for di last two qualifying games wey go happen Friday and early next week. Dem dey third place for Group C with 11 points, just three points behind leaders Benin and South Africa. Naija must win di last two games plus hope other results go […]

todayOctober 9, 2025 10

Sports

Fuludu Vex Say Dem Too Dey Suspend NPFL Coaches Anyhow

Former Super Eagles midfielder, Oedema Fuludu, don yarn say dis kind quick suspension of NPFL coaches no good for di league growth. Inside just two weeks, three coaches don kena suspension for poor performance, Napoleon Aluma for Delta Sports Commission, Tunde Sanni for Kwara United, and Greg Ikhenoba for Bendel Insurance. Fuludu talk say instead of quick suspension, management suppose sit down with coaches find solution, because dis kain quick moves no go help di game. E talk say dis […]

todayOctober 9, 2025 7

National

Gas Scarcity: Price Na Scam, Middlemen Dey Chop Nigerians – NALPGAM

Nigerian Association of Liquefied Petroleum Gas Marketers (NALPGAM) don raise alarm over how cooking gas price don dey jaga-jaga for everywhere for country, say di price wey dey now na fake. National President, Oladapo Olatunbosun yarn dis one for Channels TV The Morning Brief on Wednesday. E talk say di wahala na because PENGASSAN and Dangote Refinery fight, wey cause strike. Di strike make price waka comot from about ₦1,700 reach ₦2,000 per kilogram, and for some places, dem dey […]

todayOctober 8, 2025 18

National

Minister For Innovation, Science And Technology Don Run Comot As Dem Catch Am For Certificate Waka Gbege

Minister for Innovation, Science and Technology, Uche Nnaji, don resign as certificate wahala full ground. Bayo Onanuga, Presidential spokesman, confirm say Nnaji don step down on di night of  October 7. Reports talk say University of Nigeria, Nsukka (UNN) deny say dem ever give Nnaji Bachelor of Science degree certificate because e no finish school. UNN Vice-Chancellor, Simon U. Ortuanya talk say Nnaji come school for 1981 but e no complete and no get degree. Reports still talk say the […]

todayOctober 8, 2025 14

National

Yakubu Don Hand Over To Agbamuche As INEC Acting Chairman

Professor Mahmood Yakubu don hand over to May Agbamuche as Acting National Chairman of Independent National Electoral Commission (INEC). Agbamuche na di oldest serving National Commissioner for di electoral body. Yakubu announce dis one Tuesday during ongoing meeting with Resident Electoral Commissioners for INEC headquarters Abuja. E ask di commissioners and directors make dem support Agbamuche till new permanent chairman come. Yakubu dey leave office after completing im two-term 10 years tenure. President Tinubu dey expected to appoint im successor […]

todayOctober 8, 2025 8

International

Tunisia Free Man Wey Dem Condemn To Death Because Of Facebook Post

One Tunisian man, Saber Ben Chouchane, don free few days after dem sentence am to death for court over Facebook posts wey dem talk say offend President Kais Saied, na wetin him lawyer talk on Tuesday. Di 51-year-old man bin dey face charge like “spreading false news,” lawyer Oussama Bouthelja yarn . Di Paris-based Tunisian human rights group CRLDHT talk say di verdict na serious precedent and say Tunisia don reach serious level for human rights wahala. Bouthelja yarn say […]

todayOctober 8, 2025 12

International

One 4 Year Old Girl Drown For Private Nursery Swim Lesson Wey No Get Lifeguard

One four-year-old girl, Berra Dizi, don drown for swimming pool wey dem say too deep for children, inside one private nursery for Suleymaniye area of Inegol, Bursa Province, Turkey. Di sad incident happen on August 12 during swimming lesson. CCTV show how staff rush pull Berra from di water as she float motionless, while swim teacher try save am. Nurse give her first aid before dem rush am go hospital, but after seven days for intensive care, Berra still die. […]

todayOctober 8, 2025 15

International

Denmark Wan Ban Social Media For Pikin Dem Wey No Reach 15 Years

Denmark don yarn say dem wan ban social media for pikin dem wey no reach 15 years, as government talk say na to protect childhood and make young people mind better. Prime Minister Mette Frederiksen talk dis one for parliament on Tuesday, October 7, but she no talk which social media dem go ban or how dem go take do am. But di plan don cause plenty talk for Denmark and even outside. Frederiksen talk say dem wan stop social […]

todayOctober 8, 2025 11

Sports

Udinese: Okoye Go Show Face Next Week, Betting Ban Don Finish

Super Eagles shot-stopper, Maduka Okoye, go bounce back enter active football for Italian Serie A next week as him ban don expire. Di Udinese goalie chop sanction for late July afta dem catch am say e collect yellow card on purpose for match wey dem play against Lazio, all na inside one betting gbege wey dem rig. Na for Udinese Tonight, one Monday evening show for TV12, wey Daniele Padelli yarn say Okoye dey return back to di squad. Di […]

todayOctober 8, 2025 23

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app