Blog masonry

Background

Politics

Governor Fubara Pull Out From APC Guber Primary Election

Di Rivers State Governor, Siminalayi Fubara, don announce say im no dey join body again inside di All Progressives Congress (APC) governorship primary election for di state. Inside one statement wey im sign on Wednesday, Fubara tuk say e take di heavy decision after e do tight consultation with im family, friends, and political partners. Im sha promise to support anybody wey di party choose as dia flagbearer for di governorship race. Dis layout dey happen as proper political calculation […]

todayMay 21, 2026 24

Lagos

Desmond Elliot deny report say im nor withdraw from APC Primaries

By : Jolayemi Olajide Nollywood actor wey turn politician and Surulere Constituency 1 representative for Lagos State House of Assembly, Desmond Elliot, don clear air say im nor withdraw from Surulere APC primaries. E tuk to newsmen say wetin happen na say e pull im agents comot from di election process because of intimidation and harassment. E further explain say na only di political party get authority to direct any candidate to withdraw, and if dem do am, e go […]

todayMay 20, 2026 30

Lagos

Desmond Elliot wash hand Comot lagos state house of Assembly

By : Jolayemi Olajide Nollywood actor wey turn politician, Desmond Elliot don comot body from APC primary election for Surulere 1 House of Assembly seat. E drop di announcement on Wednesday for Paddington Mini Stadium, Western Avenue, Surulere, Lagos, where di primary election dey happen. According to am, dem lock am outside, e beg and nobody answer am.

todayMay 20, 2026 28

Sport Yarns

Chelle Drop Super Eagles List As New Players Join Unity Cup Battle

By : Jolayemi Olajide Super Eagles coachie, Éric Chelle don release squad for Unity Cup plus international friendly matches against Poland and Portugal. Team captain Wilfred Ndidi, Francis Uzoho, Moses Simon and Terem Moffi dey among di players wey make di list. New players like Arthur Okonkwo, Raphael Onyedika and Rafiu Durosinmi sef get first invitation to join di team. Nigeria go face Zimbabwe national football team for Unity Cup semi-final for Valley ground on May 26.

todayMay 20, 2026 23

obodo oyinbo

WHO Konfam Say Ebola Cases For   Congo-Uganda Don Enter 139

By : Jolayemi Olajide World Health Organization (WHO) don tuk say suspected Ebola cases for Democratic Republic of Congo and Uganda don rise reach about 600, with around 139 suspected deaths. WHO Director-General Tedros Adhanom Ghebreyesus confirm say di disease still remain public health emergency of international concern, but e no don reach pandemic level. WHO still rate di risk as high for national and regional level, but low for global level. Di organisation don start serious work to trace […]

todayMay 20, 2026 27

Entertainment

Cubana Chief Priest Opens Up say Tinubu nor trust

By : Jolayemi Olajide Wooo, wetin concern vulture with barbing saloon, Social media senior man, Cubana Chief Priest, tuk say wi oga  Presido, Bola Tinubu still dey dey look am less, cause say im  support Peter Obi for 2023 election. Cubana Chief Priest yarn this one during livestream with popular streamer Peller on Wednesday.ssss Di Imo State Coordinator of Pro-Tinubu City Boys Movement say people for presidency still dey suspect am because of im tribe and old political stand, say […]

todayMay 20, 2026 35 2

Local

Supporters scarra Ikosi-Ketu APC Primary with Stones

By : Jolayemi Olajide Nor be small jogolo for ikosi ketu today, as All Progressives Congress, lagos   State house of Assembly  primary election turn blood tap. Supporters of Dr. Seriki Muritala Ishola, wey be mata wey occupy di sit right now, dey shout one side, Amzat pipo sef dey oda coner dey shout, dem bin dey hope say dem go conclude di primaries today. Konfam news bin dey ground wey everywia scatta, na di supporters begin throw demselves stones, scatta […]

todayMay 20, 2026 44

OBODO NAIJA

FAAN Tighten Airport Checks Sake Of Ebola

By: Jolayemi Olajide News report: Federal airport authority of Nigeria, FAAN don activate extra safety doings for all international airports for Nigeria to stop Ebola Virus Disease wey don dey scatta body for some parts of Central Africa. For statement wey Director of Public Affairs and Consumer Protection, Henry Agbebire release, im talk say officials don start to screen passengers for Ebola symptoms across di airports. Di agency say dem dey work with Port Health Services and NCDC to increase […]

todayMay 20, 2026 27

obodo oyinbo

IMF Raise Alarm, Say Middle East War Fit Cause Hunger For Africans

By : Jolayemi Olajide International Monetary Fund, IMF don warn say if care is not taking di Middle East war e fit cause food crisis for Sub-Saharan Africa. Di organisation talk say di conflict fit scatter di economic progress wey di region dey enjoy after Sub-Saharan Africa enter 2026 with im strongest growth level for ten years. According to IMF, di region record 4.5 percent growth for 2025 because of lower economic pressure, more investments and reforms wey different governments […]

todayMay 20, 2026 22

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds