Blog masonry

Background

Lagos

Okpebholo Address Marras On Di Shops Wey Jaguda Boys Burn For Ekpoma

By: Esther Ayoola Following di Badness wey sup for Ekpoma over di weekend, Edo State Govo, Senator Monday Okpebholo, on Tuesday don drop promise, say di state gorment go hellep rebuild di shops wey fire burn for Ekpoma Police Division, for Esan West Local Government Area. Okpebholo tuk dis one when e visit di police station to assess di damage to di shops wey Police Officers Wives Association build. According to statement wey im Chief Press Secretary release, di gorment […]

todayJanuary 13, 2026 11

National

How Jaguda Boys Do Warling Film For Obajana Police HQ

By: Rilwan Agbomeji Say nor be small war start film play for Obajana Police Divisional Headquarters for Kogi State, dat jaguda boys enter di area and begin shoot wetin nor good kill one civil defence guide, but last last face and scata dem. Several security personnel and vigilante members sustained gunshot wunjor for di mata oh. Resident say di mata wey sup from Sunday to Monday night nor allow dem sleep. Police authorities say di area has been secured and […]

todayJanuary 13, 2026 12 2

foreign

Iran Minister Drop Yarns Dat Iran Nor Go Legbere For Anybody

By: Rilwan Agbomeji Iran Foreign Minister Abbas Araghchi, once again don tuk oh, say Iran ready for war if America wan “test” dem. Dis dey come afta US President Trump warn say im fit use military over Iran protests. Protests start over money wahala but don grow to big calls for system change. Ontop interview with tori pipo,  E say tuk channels with US still open but Iran military strong pass before, dat dem nor dey legbere for anybodi.

todayJanuary 13, 2026 21 3

Sports

Dan Evans, Oda Brit Tennis Players Chop Defeat For Australian Open

By: Rilwan Agbomeji Great Britain tennis player, Dan Evans go fall hand for Australia, fail to reach Australian Open main draw. Im go lose inside first round for qualifying phase wey sup for Melbourne. Na so im service weak like dodo, lose 6-1, 6-2 to Japan player Rei Sakamoto. Oda Britons, Jay Clarke and Jack Pinnington Jones, also lose straight sets, and Oliver Crawford lose 6-3, 2-6, 6-3 to Spain player Daniel Merida Aguilar.

todayJanuary 13, 2026 17 3

National

Edo Gorment React To Jaguda Boys Doings For Ekpoma

By: Esther Ayoola Edo State Governor, Monday Okpebholo, don condemn di attack wey hoodlums carry go Onojie of Ekpoma palace after dem hijack peaceful protest against kidnapping and insecurity for di area. Di protesters scata market, kill goats, beat cows, block major road and destroy parts of di palace, making businesses come standstill. Governor Okpebholo finally visit di palace on Monday and tuk say di violence no dey acceptable, dat gornment go take action to maintain peace for di area.

todayJanuary 13, 2026 9

National

Akwa Ibom Assembly Spoil Report, Say Dem Nor Get Plans To Jail Married Men

By: Esther Ayoola Akwa Ibom State House of Assembly don clear mata, say di social media report wey dey waka up and down, dat dem wan make law wey go jail women wey dey sleep with married men, na fat lie wey dey smell. Di Assembly tuk tuk put for statement on Monday, say di story wey come from one Facebook post by Obiavel Albert Abigo na fake news. Dem also clarify say di report wey claim Deputy Governor Senator […]

todayJanuary 13, 2026 20 1

National

President Tinubu Put Bodi For Climate Change Submit In Abu Dhabi

By: Esther Ayoola Say like dis wi oga Presido, Bola Tinubu don arrange bodi to tuk Naija mata for climate change and sustainability for Sustainability Summit wey dey sup for Abu Dhabi, UAE. Untop yanings with tori pipo, Minister of Foreign Affairs, Yusuf Tuggar tuk say Tinubu go yan with other world leaders about Nigeria climate plan and how we fit develop. Tuggar also tuk say, Oga presido go use di chance show say sustainability gats follow hand with climate […]

todayJanuary 13, 2026 23

Lagos

Lagos Court Kramp Man For Yahooing N60m Naira

By: Esther Ayoola Police for Zone 2 Lagos, don do jaki chan for one man wey dem name Israel Onen for Federal High Court over N60 million visa yahoo wey im do. Onen face four charges wey include conspiracy, fraud, money laundering, and stealing. Court hear say between 2024 and 2025, Onen joinbodi with some pipo wey sti dey on di run  collect N60 million from one innocent  Ayodele Emmanuel. Police tuk say Onen go leak Ayo ear,  pretend say […]

todayJanuary 13, 2026 15 4

Lagos

Akran Of Badagry, Oba De Wheno Menu-Toyi, Die For Age 89

By: Esther Ayoola Say nor be small badness sup for Badagry, dat De Akran of Badagry Kingdom, Oba De Wheno Menu-Toyi, don die for age 89 afta short sickness on Monday. Di respected king wey rule Badagry for almost 49 years na strong voice for Lagos State Council of Obas and Chiefs. Untop yanings with tori pipo, Lagos govo, Babajide Sanwo-Olu, tuk say im death na big loss to Badagry people, Lagos State and Nigeria because of di beta impact […]

todayJanuary 12, 2026 27 1029

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds