Blog masonry

Background

Lagos

LIRS Extend Tax Return Deadline To 14 April

Lagos State Internal Revenue Service (LIRS) don extend di deadline for individual annual tax returns from 1 April go 14 April 2026. Di Head of Corporate Communications, Monsurat Amasa-Oyelude, na im tuk dis one for statement, say dem do dis to give pipo more time to complete di tax returns process. You sabi say, di federal gornment don already say every Nigerian gatz file tax returns by 31 March under di new tax law. Taiwo Oyedele, wey be former chairmo […]

todayApril 1, 2026 26

National

Court Adjourn El-Rufai Corruption Case Again

Say nor be small gbege for court as Former Kaduna State Governor Nasir El-Rufai show face for Federal High Court for Kaduna on Tuesday over alleged corruption case wey ICPC carry come. During di sitting, na so Rufai lawyer, Ukpon Akpan, cut chain follow Justice Rilwan Aikawa say make im step aside for di case dat di judge dey bias but later withdraw di request. Based on di jogolo, di Court no fit continue with bail hearing because say di […]

todayMarch 31, 2026 31

Entertainment

Iyabo Ojo Comot Body For Funke Akindele And Toyin Abraham Fight

Nollywood actress Iyabo Ojo like dis na say, she don to find settlement for Funke Akindele and Toyin Abraham. She yan dis one for her Instagram on Tuesday, say pipo don dey insult her because of di mara. Iyabo say she and Funke na friendship for years now, on dis mata say she don try settle dem but no answer. She add say she try settle things between Funke and Toyin, but now she no go dey involve again.

todayMarch 31, 2026 36

National

Tinubu Message National Assembly To Increase 2026 Budget To ₦67.4 Trillion

Wi oga Presido, Bola Tinubu don write National Assembly make dem increase di 2026 budget by ₦9 trillion, from ₦58.4 trillion go ₦67.4 trillion. Oga Senate Presido, Godswill Akpabio, read di letter for Senate floor on Tuesday. Tinubu tuk say di increase go hellep manage gorment mata wella . E also say e go cover past legal commitments, manage gornment debt, and fund few important projects without stress for domestic market.

todayMarch 31, 2026 28

obodo oyinbo

How Iran Fires Missiles Across Middle East

Say like dis Iran don fire missile across Middle East afta fresh explosion hapun for Tehran on Tuesday According to local media, say di thing cause power cut for parts of di city. Nor be amebo say US Presido, Donald Trump tuk say e fit attack Iran oil hub, power stations, and water plants to stop dia threat, as dia peace tuk nor dey get head. Israel Prime Minister Benjamin Netanyahu say more than half of dia military target don […]

todayMarch 31, 2026 28

National

Oga Presido Tinubu Send Letter Of $6B Foreign Loan To Senate

Wi oga Presido Bola Tinubu, don enter senate again dey ask dem to approve $6 billion loan from outside to help run gornment. Na for two separate letters request  him send to Senate President Godswill Akpabio and naim im put dis one and dem read during Tuesday’s plenary. For one letter, e dey seek $5 billion from Abu Dhabi Bank to hellep finance budget. For another letter, e ask for $1 billion from Citibank for fix key port work like […]

todayMarch 31, 2026 17

National

New Ogun Cp Ojajuni Officially Report For Duty Post

Ogun State new Police Commissioner, Bode Ojajuni, don resume work yesterday for Ogun State say im go ensure law and order Di CP say im go make sure say im officers respect pipo rights and follow law and rules. Ojajuni con sti beg bed di public make dem dey respect police and join hand with dem to fight crime

todayMarch 31, 2026 40

National

President Tinubu Tell Security Make Dem Hunt Killers Weh Attack Plateau, Kaduna

Wi oga Presido, Bola Tinubu don tell security mehn make dem hunt down di jaguda boys wey dey behind di killings for Plateau State and Kaduna State. Nor be amebo say Gunmen kpai about 28 pipo for Angwan Rukuba, Jos, and some others attack Kahir village for Kaduna, kill plenty pipo. Tinubu say di kpaing and wedding abduction na shame for Naija and make security agencies dey pursue di criminals plus people wey dey spread fake news. E also urge […]

todayMarch 31, 2026 22

National

Former Deputy Kano State Govo Gawuna Catapult From APC

Former Kano State deputy governor, Nasiru Gawuna, don resign from All Progressives Congress. Im write letter go di APC chairmo for Gawuna Ward, Nassarawa Local Government Area,  say na im own personal decision, and e effective March 29, 2026. Gawuna thank di party for di opportunity wey e get as member. Him resignation follow im 2023 governorship ambition for APC wey nor work and aside dat one, im nor give any reason.

todayMarch 31, 2026 22

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds