Blog masonry

Background

Lagos

Customs Seize 3,398 Cartons Of Codeine Syrup Worth N3.39bn For Apapa Port

Di Nigeria Customs Service Apapa Command say, dem don seize 3,398 cartons of codeine syrup wey smugglers hide inside household utensils for Apapa Port, Lagos, worth about N3.39 billion. According to di command tuk, tuk, Isa Sulaiman, di interception hapun on Sunday, after customs officers carry out quick follow-up operation. Sulaiman quote di Customs Area Controller, Emmanuel Oshoba, say di operation na success through joint work with di National Drug Law Enforcement Agency. Oshoba say di seizure show di command […]

todayMarch 17, 2026 23

Sports

Ikorodu City Shock Rivers United, Win 1-0 for Lagos

By: Esther Ayoola Ikorodu City don shock everybody as dem beat Rivers United 1-0 for Mobolaji Johnson Arena, Lagos, on Monday. First half no  goal, but both teams try score sha. Rivers United wey everybody dey reason say dem go win di league no fit break Ikorodu defence. Na For di 52nd minute, substitute Folarin Temitope score from rebound wey goalkeeper Rashid Owolabi no fit hold after Salami Farouk try shot, ni settle di tie.

todayMarch 17, 2026 25

Sports

D’Tigress Finally Collect Dia Rewards Afta Afrobasket 2025 Win

By: Esther Ayoola Naija gornment don finally give D’Tigress wetin dem promise afta dem win FIBA Women’s AfroBasket 2025 for Côte d’Ivoire. Dem don collect dia national honour certificate and housing documents as reward. Di presentation hapun for Lyon, France, as dem dey play FIBA Women’s World Cup Qualifiers. Say Each player also carry $100,000 plus flat and the Order of di Niger (OON) wey Presido, Bola Tinubu promise since August 4, 2025.

todayMarch 17, 2026 28

Sports

Real Madrid & PSG Eye Victor Osimhen for Summer Transfer Move

By: Esther Ayoola Real Madrid and Paris Saint-Germain dey watch Victor Osimhen for possible transfer dis summer. Turkish journalist Ali Naci Küçük tuk dis one on Monday, say Real Madrid don put Osimhen and Erling Haaland for their transfer list. E sti press tuk say senior men from Real Madrid and PSG even enter Rams Park last Tuesday to watch Osimhen when Galatasaray play Liverpool for UEFA Champions League. Real Madrid don dey follow Osimhen, especially as some of dia […]

todayMarch 17, 2026 37

Sports

DR Congo Ready For 2026 World Cup Play-Off

By: Esther Ayoola Sébastien Desabre, coach of DR Congo national football team, say like dis im boys don dey jim bodi for dia 2026 FIFA World Cup intercontinental play-off. Say Dem go travel to Mexico, play for Guadalajara and Monterrey, join other five countries wey dey fight for di last two spots. DR Congo, wey beat Naija 4–3 on penalties for African play-off final, go face di winner between Jamaica and New Caledonia. Desabre hope be say im fit carry […]

todayMarch 17, 2026 32

Lagos

Deputy Governor Hamzat Tell Civil Servants To Learn Work Well

Lagos State Deputy Governor, Dr Obafemi Hamzat, don call on civil servants to show honesty, care, and professionalism. E tuk dis one on Monday for di 60th birthday and retirement thanksgiving service of Permanent Secretary for Office of Deputy Governor, Mobolaji Daba for Chapel of Christ the Light, Alausa-Ikeja. Hamzat say e important, make civil servants sabi dia work, responsibilities, system, protocols, and wetin e need to serve public well. Im advise dem to dey serious, follow rules, and understand […]

todayMarch 17, 2026 22

Lagos

Sanwo-Olu Launch $25m Fund To Carry 50,000 Out-Of-School Pikins Back To School

Lagos State  Govo, Babajide Sanwo-Olu don release $25 million, Lagos Education Access Fund to hellep enroll about 50,000 pikins wey no dey school enter formal education for di state. Baba govo make di announcement during di unveiling ceremony wey happen for Lagos House Marina. According to di Govo, di Lagos State gornment remain committed to make sure say every pikins for Lagos get access to free and quality basic education.

todayMarch 17, 2026 27

National

President Tinubu To Meet PM Starmer, King Charles For UK

By: Esther Ayoola Wi oga Presido Bola Tinubu like dis don dey arrange im kaya to enter United Kingdom to meet Keir Starmer for bilateral tuk. According to a post by di British gornment, baba Seyi go land UK on March 18 for Windsor Castle, wia Prince William and Catherine, Princess of Wales go welcome am. Say di visit na to strengthen Nigeria-UK relations and show respect to di Queen and King, plus meet Nigerians for diaspora.

todayMarch 16, 2026 62

National

Ondo Police Gbab Notorious Cult Leader Bella For Owo

By: Esther Ayoola Ondo State Police Command don arrest one suspected cult leader wey dem dey call Akinwale Tomiwa for Owo, Owo Local Government Area. Police tuk, tuk, DSP Abayomi Jimoh, say di arrest hapun on Sunday afta Special Anti-Cultism Squad for Akure get correct intelligence. Di Police say Tomiwa, wey pipo sabi as Bella, dey involved for killing of one Rufus Giwa Polytechnic student, Ojo Peter and other crimes. So like dis say, Tomiwa dey under go interrogation for […]

todayMarch 16, 2026 54

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds