Blog masonry

Background

National

Arms Smugglers Kill Customs Boy, Vanish For Kainji Forest

Arms smugglers don kill one Nigerian Customs errand boy, wey dem dey call “camp boy,” for Babana, one Niger State village wey dey border Benin Republic. After dem shoot di boy for road, di smugglers waka go inside Kainji National Park through Audu Fari road. People dey suspect say dem dey carry weapons go supply Ansaru terrorists wey dey operate for North-central Nigeria and northern Benin. Customs “camp boys” na unofficial helpers wey officers dey use for border and ports, […]

todayOctober 22, 2025 17

National

35 Kpai, 40 Dem Injure As Dem Dey Scoop Fuel For Niger State

Tragedy burst for Katcha Local Government Area, Niger State as one fuel tanker blow, kill 35 people and injure 46 others. The gbege happen for Agaie-Bida Road, Essa village, Tuesday afternoon, October 21, 2025, as people dem dey scoop petrol wey spill from fallen tanker. The tanker fall around 11am because road no too good for Essa, near Badeggi town, and people rush go scoop fuel before di tanker explode around 2pm. FRSC Niger Sector Commander, Hajiya Aishatu Sa’adu, confirm […]

todayOctober 22, 2025 23

National

One Lost, Two Wound As Thieves Raid Osun Varsity Hostels

Two students for Obafemi Awolowo University, Ile-Ife, chop injury as armed robbers wey carry cutlass and gun invade some off-campus hostels for night attack wey happen around 11pm on Monday. Di robbers break windows, wound students and carry waka with phones, MacBook, money and other belongings. One student wey no gree drop him phone chop cutlass injury. Dem still go attack another hostel, Peace Hostel, collect wetin students get. Students try pursue dem but di robbers fire gun for air […]

todayOctober 22, 2025 14

National

Kano Court Don Order TikTokers Make Dem Marry Within 60 Days

Magistrate court wey dey for Kano don order two popular TikTokers, Idris Mai Wushirya and Basira Yar Guda, make dem marry within 60 days, based on viral videos wey di Kano State Films and Video Censorship Board tag as “indecent.” Di video clips show di two dey do romantic touching and body movement wey authorities talk say e no follow di moral and religious values wey Kano State dey stand for. Magistrate Halima Wali wey preside over di case on […]

todayOctober 22, 2025 20

Sports

Haaland Don Show Power Again As Man City Run Villarreal Street

Erling Haaland still dey hot as e score again make Manchester City collect easy 2-0 win for Villarreal for Champions League on Tuesday. Pep Guardiola side no lose since dem start league phase as Haaland open scoring before half with help from Rico Lewis, then Bernardo Silva add second goal to kill Villarreal momentum. Haaland don score for each of him last 12 games for club and country, rack up 22 goals for dat period. Guardiola rest Phil Foden and […]

todayOctober 22, 2025 23

Sports

PSG Beat Leverkusen 7-2 For UCL

Ousmane Dembele show im return from injury sharp sharp as PSG run Bayer Leverkusen street 7-2 for Champions League match wey happen for BayArena stadium, Germany. Dembele score PSG sixth goal just three minutes after im enter second half for im first game since im hamstring injury from September. Desire Doue score two goals, while Willian Pacho, Khvicha Kvaratskhelia, Nuno Mendes and Vitinha add dia own goal as PSG show say dem still get power to defend dia European crown. […]

todayOctober 22, 2025 17

Sports

Newcastle Thrash Mourinho Benfica For Champions League

Harvey Barnes score two goals from bench as Newcastle carry 3-0 hammer land Jose Mourinho Benfica for Champions League showdown for St. James’ Park. Anthony Gordon open di scoring for first half, as Benfica still dey waka with zero point for dis Champions League season. Barnes enter after one hour play and scatter di show with two correct right-footed finishes wey help Newcastle dey on track to qualify from di league phase. Newcastle don bounce back strong after dem lose […]

todayOctober 22, 2025 30

Sports

Cristiano Ronaldo Pikin Don Get Him First Call-Up To Play For Portugal U16 Team

Cristiano Ronaldo pikin, Cristiano Ronaldo Jr, don get him first-ever call-up to Portugal U16 team. Di 15-year-old wey dey play for Al Nassr youth team for Saudi Arabia, same club where im papa dey ball, land inside 22-man Portugal squad wey go play for di Federations Cup Tournament for Turkey. Di tournament go run from October 30 to November 4, and Portugal go face Turkey, Wales and England for di group stage. Ronaldo Jr first show for Portugal U15 team […]

todayOctober 22, 2025 21

Sports

LaLiga Don Cancel Barcelona vs Villarreal Match Wey Dem Wan Play For Miami

LaLiga don cancel dia big plan to play Barcelona vs Villarreal match for Miami dis December. Dem announce am on Tuesday say na Relevent, di league’s partner for North America, pull plug because of di wahala and kata kata wey di match don cause for Spain. According to LaLiga, di mata don bring serious gbas gbos and uncertainty for Spain, so dem no fit go ahead again. Dem talk say di match for Hard Rock Stadium for Miami suppose be […]

todayOctober 22, 2025 15

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds