Blog masonry

Background

Sports

Dembélé Na Im Win Ballon d’Or

France and Paris Saint-Germain front-man, Ousmane Dembélé, don wear crown as 2025 Ballon d’Or winner, lock im space for where football big names dey. As dem announce am for Théâtre du Châtelet for Paris, everywhere burst, celebration join shock hold people.  After wahala-full career for Barcelona wey injury and up-and-down play scatter, na when e move go Paris e unlock new level, come finish di season with success wey nobody don see before. Dembélé, 28 years, knack Barcelona and Spain […]

todaySeptember 23, 2025 26

International

United States Don Promise Say Dem Go Block Visa For All Big Corrupt Nigerians

U.S. Mission for Naija don talk am again say dem no dey smile with corruption, warn say big men wey hand dirty fit lose chance to enter America. For one message wey dem drop for X, U.S. Mission for Naija talk say the fight against corruption no get border. “To fight corruption no get limit or boundary. Even if na big man enter corruption matter, we fit still block am from collect U.S. visa,” na wetin dem talk be that. […]

todaySeptember 23, 2025 17

Lagos

Lagos Dun Tell Pikin Dem Say Make Dem Raise Alarm Incase Anybody Dey Abuse Dem.

Lagos government, through its Domestic and Sexual Violence Agency, don beg pikin dem make dem speak out anytime dem face any kind violence or abuse. Na di Executive Secretary of DSVA, Titilola Vivour-Adeniyi, drop this advice during their ‘Safeguarding and Child Protection Day’ wey happen on Monday for Ikeja. Ms Vivour-Adeniyi talk say Child Protection Week na part of Lagos State Domestic and Sexual Violence Awareness program wey dem plan to protect pikin dem. She talk say pikin dem need […]

todaySeptember 23, 2025 17

Lagos

Lagos Drop Athletes Wey No Dey Perform, Bring in New Stars

Lagos State Sports Commission don begin recruitment of new athletes into their senior team after dem disband the old team wey dem label as “unproductive and undisciplined.” On Friday, the Director General of the Lagos State Sports Commission, Olalekan Fatodu, officially dissolve Team Lagos, and come direct say make only the “productive ones” reapply for new opportunity. People dey believe say the decision no be ordinary, as e fit get connection to the recent protest wey some senior athletes do […]

todaySeptember 23, 2025 18

Lagos

Lagos Dey Find Investors for Waste-to-Energy and Climate Change Projects

Lagos State government don talk say dem ready to work with investors for areas like turning waste to energy, waste to wealth, and how to manage liquid waste well. Commissioner for Environment and Water Resources for the state, Tokunbo Wahab, talk this one when he show face as one of the panellists for Harvard University Climate Action Week, wey theme be: “Rising Seas, Resilient Communities, Climate Adaptation Strategies in West Africa.” According to am, the current government for Lagos don […]

todaySeptember 23, 2025 22

Lagos

Dangote CNG Trucks Don Start to Deliver Fuel to Filling Stations for Lagos

Dangote Petroleum Refinery & Petrochemicals don begin supply petrol give petroleum marketers for different areas of Lagos using their new trucks wey dey run on compressed natural gas (CNG). One of the trucks wey carry Dangote logo bin dey offload fuel for Conoil filling station wey dey directly opposite Ikeja General Hospital. This move na one big step to change how fuel dey move around Nigeria, reduce transport wahala and make fuel reach customers faster and cheaper. The truck, wey […]

todaySeptember 23, 2025 12

Sports

Dembele And Yamal Dey Run Race For Ballon d’Or Glory

Paris Saint-Germain forward Ousmane Dembele dey gats hold body pass Barcelona star Lamine Yamal to win men Ballon d’Or on Monday, while Aitana Bonmati fit carry third women Ballon d’Or back-to-back. Football world go gather for big big ceremony for Theatre du Chatelet, Paris, to know who go be next winner of award wey Lionel Messi and Cristiano Ronaldo don hold for long time. Those two na im win Ballon d’Or 13 times between 2008 to 2023. Di award, wey […]

todaySeptember 22, 2025 57

Sports

“Di Fixture Schedule No Fair To Man City” – Silva Yarn

Manchester City midfielder Bernardo Silva talk say him team dey for disadvantage against Arsenal because of how Premier League take arrange di fixtures. Gabriel Martinelli score for added time to give Arsenal 1-1 draw for Emirates Stadium on Sunday. City get 66 hours to prepare for di match after dem 2-0 home win against Napoli for Champions League on Thursday. Arsenal win 2-0 against Athletic Club for Bilbao on Tuesday. "E no fair to play one of these games like […]

todaySeptember 22, 2025 29

International

Peru Don Mark Second Day Of Gbege Anti-government Protest

Plenty anti-government protesters for Peru capital Lima jam street again on Sunday after gbege wey injure like 18 people, police and journalists join body. Di youth wey dey lead, “Generation Z,” carry another big march waka go where President Dina Boluarte dey work for downtown Lima, police come full ground dey guard. Trouble don dey boil for Peru since some months now, as gbege with organized crime and extortion don full ground. Plenty people for poll talk say government plus […]

todaySeptember 22, 2025 45

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app