Blog masonry

Background

Sports

D’Tigress Drop Provisional Squad for Women’s World Cup Qualifiers

Nigeria seven-time African champions, D’Tigress, don announce dia provisional squad for FIBA Women’s Basketball World Cup Qualifying Tournament wey go hold for Lyon, France from 11–17 March 2026. Coach Rena Wakama pick mix of experience players and new talents wey go face France, Germany, South Korea, Colombia and Philippines. Big names like Amy Okonkwo, Sarah Ogoke, Promise Amukamara and Ezinne Kalu dey lead di team, plus young guns like Pius Idubano and Wandoo Hemba. Full roster still get plenty players […]

todayFebruary 26, 2026 35

Lagos

President Tinubu Appoint Tunji Disu As Acting Police IGP Afta Egbetokun Resign

By: Esther Ayoola Wi President Bola Tinubu don appoint Assistant Inspector-General of Police Tunji Disu as Acting Inspector-General of Police afta Kayode Egbetokun resign from di position. For statement wey presidential tuk,tuk Bayo Onanuga release on Tuesday night, di President say di appointment take effect immediately because of security challenges for di country. Dem say according to Police Act 2020, Tinubu go soon call meeting for Naija Police Council to consider Disu as di main man for di IGP role […]

todayFebruary 25, 2026 38

Lagos

Lagos CAN Name Dia New Secretariat Afta Oluremi Tinubu for Alausa

By: Esther Ayoola Lagos State branch of Christian Association of Nigeria don rename dia permanent secretariat afta Oluremi Tinubu, almost 30 years afta dem open di place. U sabi say di building wey dem dey name “Senator Oluremi Tinubu CAN Lagos State Secretariat” for Alausa, Ikeja, na Daniel Okoh, di national president of CAN, na im officially open am. Okoh praise Lagos CAN members for dia ogbonge doings and unity to make di project become reality. One floor of di […]

todayFebruary 25, 2026 19

National

Akure Police Commando Gbab 10 Suspected Kidnappers For Ondo State

By; Esther Ayoola Police for Ondo State don arrest 10 suspected kidnappers for Akure and recover ransom money wey dem collect from dia victims. Police tuk, tuk, Jimoh Abayomi, konfamate to tori pipo, from force headquarters, say di arrest na big breakthrough as dem dey continue crackdown on kidnapping and other violent crimes for di state. Say na joint operation between Anti-Kidnapping Section and PMF personnel from Force Headquarters carry out di arrest afta dem get solid intelligence along Ondo […]

todayFebruary 25, 2026 25

National

Ogbomoso Askident Kpai Pregnant Woman, Five Final Year Student For Kwara

By: Esther Ayoola Six people, including one pregnant woman and five final-year nursing students, say ni kpai for one big car askident for Kwara side of Ilorin, Ogbomoso road. FRSC Kwara commandant, Rosemary Alo, konfam say di askident hapun for Ote area for Kwara. Alo say, Some of di victims kpai on di spot, while some others kpai for hospital. Say di five nursing students, na 500-level students wey dey do Open and Distance Learning for one higher institution for […]

todayFebruary 25, 2026 33

National

APC Govos, Presidency Ginger Bodi For Grassroot Issues

By: Esther Ayoola All Progressives Congress Governors forum don go put bodi for grassroot doings to push di Renewed Hope Agenda of President Bola Ahmed Tinubu, say time don reach for dia reform to show workings. Untop di yarnings for di PGF Renewed Hope Ambassadors Summit 2026, Vice President Kashim Shettima ni carry di mata dey yarn, say time don pass wey dem go dey tell pipo to manage di pain, dis na time to show workings, particularly with di […]

todayFebruary 25, 2026 20

National

Obi, ADC Drag APC Say Dem Use Hunger Finish Nigerians

By: Esther Ayoola Di 2023 labour parti presidential candidate, Peter Obi once again don drag di All Progressives Congress gornment afta gunmen, wey be suspected political thugs, attack some African Democratic Congress chieftains for house of John Odigie-Oyegun for Benin City, Edo State. Say, di attack hapun shortly afta di party leaders come back from ADC secretariat wia dem formally welcome Olumide Akpata join di party. Obi fry mouth untop di incident and dat, di APC gorment wan kill Naija […]

todayFebruary 25, 2026 26

National

FG Knock US Congress, Say No Be Religious Persecution for Naija

By: Esther Ayoola Wi Federal Gornment once again don react to US Congress tuk about alleged attack on Christians, say nobody dey support any kind religious persecution for Naija. On Monday, US House Committees on Appropriations and Foreign Affairs submit report to White House, recommend sanction over wetin dem call persecution of Christians for Naija. Reacting, Minister of Information, Mohammed Idris, say Naija never get any gornment policy wey target Christians, and say di wahala na from terrorism, banditry and […]

todayFebruary 25, 2026 22

obodo oyinbo

Drone Attack Hit Kordofan Market, Sudan, Kpaing Plenty Civilians

By: Esther Ayoola Say di story dey worwor everyday for Sudan, dat drone attack don kpai plenty civilians for south-central Kordofan, Sudan. According to report from UN and humanitarian pipo, Fighting between Sudan army and Rapid Support Forces (RSF), don reach another level, as pipo dey kpai, kapi every day. UN officials say, drone hit market, hospital, aid convoy, and house, wey civilian bin dey hide. Dem warn say, di war dey worse by di day, and peace effort from […]

todayFebruary 25, 2026 27

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds