Blog masonry

Background

Entertainment

Dem No Pay Me For Voice P-Square Do Me — Waje

Nigerian singer Waje don open up say she no collect shishi for di voice wey she drop for P-Square 2007 banger “Do Me.” She yarn dis one for HonestBunch Podcast as she remember her early hustle for music industry. According to her, di collabo wey first make Nigerians sabi her voice no bring any money or official recognition. “I no earn even one kobo from P-Square’s Do Me,” she talk with small laugh and reflection. Di track wey dey for […]

todayNovember 5, 2025 33

International

UK Don Order Poultry Restriction As Bird Flu Dey Spread

Di UK goment don order make all poultry and captive birds for England remain indoors from Thursday, November 6, as bird flu don begin waka up and down for di country. For di statement wey dem drop on Tuesday, November 4, di Department for Environment, Food and Rural Affairs (DEFRA) talk say di new rule go affect anybody wey get more than 50 birds or dey sell or give egg to people. Dis one na to help control di avian […]

todayNovember 5, 2025 17

International

Child Bride Fit Die If She No Raise £80,000

One young woman for Iran wey dem force marry as pikin dey face execution by hanging for di murd£r of her husband unless she fit raise £80,000 to settle di man family. Di woman, Goli Koohkan, now 25, marry her cousin when she be just 12 years old, and born her first pikin at 13. By 18, she don dey for prison after court sentence her to de@th for di man k!lling. Reports say di wahala start when her husband […]

todayNovember 5, 2025 35 3

International

TP Mazembe Fan Kpai For Machete Fight With Lupopo Fans

Big wahala don shelle for Congo as TP Mazembe confirm say one of dia fans don die after machete knack am during Sunday Linafoot derby against FC Saint-Eloi Lupopo. Di five-time African champions talk for statement wey dem drop on Monday say di fan die for Lubumbashi Kenya area after di violent clash. “TP Mazembe dey mourn di death of one of dia supporters wey die on Sunday, November 2nd, for Frederic Kibassa-Maliba Stadium,” di club yarn. “Dem hit am […]

todayNovember 5, 2025 37

Sports

French Forward Désiré Doué Don Win 2025 Golden Boy

French forward Désiré Doué don win di 2025 Golden Boy afta im season full of trophies with Paris Saint-Germain. Di award wey Italian sports paper Tuttosport dey give na for di best player wey dey 21 years or under for any top European league. Di midfielder wey dey out with thigh injury, collect di award pass players like Dean Huijsen, Pau Cubarsí, Arda Güler, and Franco Mastantuono. Doué follow di footsteps of other French stars like Paul Pogba (2013), Anthony […]

todayNovember 5, 2025 64

National

New Edo Law: Force Enter Govt Property, You Go Jail — Okpebholo

Edo State Governor, Monday Okpebholo, don sign new law wey go carry 10 years jail for anybody we force or violently enter government property for di state. Di governor still sign another section wey talk say anybody we sell or transfer government land without di governor consent go face five years imprisonment. Dis one follow statement from di governor Chief Press Secretary, Fred Itua, wey drop on Tuesday for Benin. Itua talk say di new Edo State Public Property Protection […]

todayNovember 5, 2025 35

International

Young Mum, 23, Di£S Of Alcohol Poisoning After She Try Six Drinking Challenges For Her Birthday

Young 23-year-old mum, María José Ardila, don di£ after she try six drinking challenges for her birthday for nightclub for Colombia. María, wey get 10-month-old pikin, dey celebrate her birthday days before she go turn 24, and she dey also celebrate with friends before she move go US wey her husband dey. Di challenge happen for Sagsa nightclub for her hometown Cali. Di challenges include double shots, beer, spirits, and even drinking shots through straw. For di final challenge, she […]

todayNovember 5, 2025 23

National

6-Month Pregnant Woman R@Ped, Husband K!Lled – Nigerian Doctor Yan Zamfara Bandit Horror

Nigerian doctor, Iye Abel, don share her harrowing experience wey she face during her mandatory housemanship for health facility wey dey bandit-ravaged Zamfara community. For Facebook post on Monday, November 3, 2025, Iye yan say bandits dey commit ‘unhindered wickedness’ for villagers, and even soldiers no dey left out as dem dey suffer serious injuries while protecting people. She talk how she dey suture different kinds bullet wounds, including for victims private parts, and how medical officers for surgery department […]

todayNovember 5, 2025 56 4

Entertainment

Blessing CEO Drag Nigerians Wey Dey Blame Rita Daniels For Regina Marry Ned Nwoko

Relationship expert, Blessing Okoro aka Blessing CEO don drag Nigerians wey dey blame Rita Daniels for allowing her pikin, actress Regina Daniels, marry Ned Nwoko. Since Regina and Ned marital wahala don show online, some people don dey bash Rita Daniels say she allow her pikin enter polygamous marriage with older man. Blessing CEO come defend Rita, talk say plenty children at Regina age fit rebel and no dey hear word from their parents. She ask Nigerians make dem stop […]

todayNovember 5, 2025 46

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds