Blog masonry

Background

Lagos

Family Beg Nigerians Make Dem Help Find Mama Wey Don Miss For Lagos

One 45-year-old mama, Oluwafunmilayo Oluwaseun Adesuyi, don miss for Ibeju-Lekki area of Lagos State, and her family dey beg Nigerians make dem help find her. Di woman, wey be hairdresser wey dey live for House 1, Road 1, Onidogbo Town, Aiyeteju, Ibeju-Lekki, don miss since September 17, 2025. Her eldest pikin, Boluwatife Adesuyi, and her brother-in-law, Adekunle, talk say di mother of four last leave house dat Thursday morning and never return till today. Dem describe her as tall and […]

todayNovember 5, 2025 24

Sports

Arsenal’s Max Dowman Break UCL Record At 15 Years

Arsenal young midfielder, Max Dowman, don write him name for football history book as di youngest player wey ever play for UEFA Champions League. Di 15-year-old wonder boy enter pitch for 73rd minute to replace Leandro Trossard as Arsenal knack Slavia Prague 3-0 on Tuesday, November 4. At just 15 years and 308 days old, Dowman break di record wey German striker Youssoufa Moukoko hold since 2020 when e play for Borussia Dortmund at age 16. Dis make am di […]

todayNovember 5, 2025 32

National

Tinubu Still Calm Despite Trump Threat Say Him Go Use Military — FG Talk

Di Nigerian Federal Government don talk say President Bola Tinubu still dey calm and focused on how to keep di country safe, even as U.S. President Donald Trump threaten say him fit use military action against Nigeria. Minister of Information and National Orientation, Mohammed Idris, yarn dis one after meeting for Presidential Villa, Abuja. Idris talk say Tinubu dey handle di matter maturely and dey work to make sure di international community sabi wetin Nigeria dey do to maintain peace. […]

todayNovember 5, 2025 43

Sports

Cristiano Ronaldo Talk Say He Go Marry For 2026 — With World Cup Trophy By Him Side

Football legend Cristiano Ronaldo don finally reveal when he go marry him long-time babe, Georgina Rodriguez, after nine years of being together. Di couple wey don already announce dia engagement for August, share di good news with fans as Georgina post picture of her sparkling ring for Instagram with caption, “Yes I do. In this and in all my lives.” Ronaldo tell Piers Morgan for new interview say di wedding go happen next summer after di 2026 World Cup, and […]

todayNovember 5, 2025 264

Lagos

Lagos, NCF Don Call For Join Body Fight Against Plastic And Dirty Environment

Lagos State Government and di Nigerian Conservation Foundation (NCF) don call on Lagos people and companies make dem join hand fight plastic wahala and dirty environment wey don dey choke di state. Governor Babajide Sanwo-Olu yarn dis one for di 19th Walk for Nature event wey happen for Yabatech, where im talk say di theme “Lagos, Let’s Beat Plastic Pollution” no just sweet for ear, e serious well-well. Di governor wey send im Special Adviser on Environment, Engr. Olakunle Rotimi-Akodu, […]

todayNovember 5, 2025 41

International

“Donald Trump Fit Change Di World” – Cristiano Ronaldo

Cristiano Ronaldo don hail United States President Donald Trump, call am “one of di guys wey fit help change di world.” Di 40-year-old Portuguese superstar yarn di talk for one interview with British journalist Piers Morgan, where e open up about life, football and world politics, something wey e rarely dey talk about. Ronaldo comment don scatter reactions for social media as plenty people dey argue because of Trump controversial leadership. According to di Al-Nassr forward, “Donald Trump na one […]

todayNovember 5, 2025 32

Sports

Liverpool Show Class Beat Real Madrid For Anfield

Liverpool don show say dem don return to top form as dem outclass Real Madrid 1-0 for Anfield with one commanding Champions League performance under Arne Slot. Di Reds rediscover di fire, belief and pressing wey define dia title-winning season, and Real Madrid no fit match dem energy or organisation. Alexis Mac Allister, wey score for last season 2-0 win against Madrid, come be di hero again as e nod home di only goal from Szoboszlai’s fine free-kick after Ryan […]

todayNovember 5, 2025 23

Sports

Ten-Man Bayern Still Beat PSG 2-1 for Paris

Bayern Munich don show say dem no dey joke dis season as dem beat PSG 2-1 for Paris, even after dem play with ten men. Di German champions don now win all 16 matches wey dem don play dis season, as Luis Diaz score two goals before dem send am commot for violent tackle on Achraf Hakimi just before half-time. PSG try come back as Joao Neves score one fine scissor kick, but e no still reach. Di defeat na […]

todayNovember 5, 2025 26

Sports

Arsenal Wipe Slavia Prague Clean

Arsenal don continue dem hot form for Champions League as dem hammer Slavia Prague 3-0 for Czech Republic on Tuesday night. Mikel Merino score two second-half goals wey help di Gunners secure dia fourth straight win for di competition and make am 10 wins back-to-back for all tournaments. Bukayo Saka first open di scoring for 32nd minute with penalty after Slavia captain Lukas Provod handle ball for box. Merino come double di lead 30 seconds into second half after Leandro […]

todayNovember 5, 2025 26

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds