Blog sidebar

Background

Sports

Liverpool Table Salah Marra Ahead Of Chapion’s Leaque

By: Alice Iduh Liverpool star mohamed salah fit miss team waka to italy for champions league match against inter on tuesday. According to reports, di club dey hold internal talk after salah yarn some strong words earlier dis week, Transfer expert, fabrizio romano post for x, coach arne slot go talk to press later today to explain wetin dey happen and go reach decision today.

todayDecember 8, 2025 8

Lagos

Two Pipo Die, Two Injured For Early-Morning Accidents Across Lagos

By: Esther Ayoola Nor be small tin oh,  Lagos State Traffic Management Authority (LASTMA) again don sama warning give  motorists  say make dem drive carefully after  Two separate accidents for Lagos early mor mor on monday claim two lives and leave two others badly wunjured. Na for inside  statement wey  agency  release give tori pipo, them give report that, The first crash happen around 2:30 a.m. for Otedola Bridge when […]

todayDecember 8, 2025 7

obodo oyinbo

Benin: 14 Pipo Land Jail After Soldiers Try Overthrow Talon

By: Esther Ayoola Unto updates, say na About 14 pipo don land for jail after dem try run coup on Sunday to comot benin Republic Presido President Patrice Talon According government tuk tuk persin, Wilfried Leandre, Di attempted coup burst December 7, when some soldiers talk say dem don overthrow President Patrice Talon, even carry control of government and state TV small time, hwoever, say dem don arrest 14 pipo […]

todayDecember 8, 2025 6

Lagos

Lagos Security Trust Fund Begin Waka Improve Security

By: Esther Ayoola Lagos State Security Trust Fund don come again with another plan say dem want  make people dey involved, accountable, and join hand with others to improve security for Lagos. According, the new CEO of the trust fund,  Ayodele Ogundan to aThe Fund go soon form, monitoring team, to dey oversee things. Ogundan talk say dem wan make sure say every contribution dey make difference for street and […]

todayDecember 8, 2025 7

Entertainment

Yvonne Jegede Explain How She Land 2baba ‘African Queen’ Video

By: Esther Ayoola Nollywood actress Yvonne Jegede  don clear clear marras for ground on  how she land role for 2Baba classic hit, African Queen, and the story full with wahala and surprise. The movie star explain oh, that she bin  dey shoot movie, Missing Angel, when her phone ring, and that call  actually change her life as she nor take expect. Chairmo  Charles Nova self bin dey near her, when […]

todayDecember 8, 2025 9

International

Benin Coup Fail As Loyalist Troops Hold Ground

By: Alice Iduh Benin republic presido, Patrice Talon, don show for TV clear  citizens, say di coup mata  wey soldiers try run, shake everywhere for the kontri,  don dey under control.   E hail di army and dia oga-dem wey hold loyal ground, no shakement at all.   The government talk say dem don succeed scarra  mutiny hours after a group of soldiers bin declare for  national tv dat dem […]

todayDecember 8, 2025 5

National

Tinubu, Macron Aleign Marras On Nigeria Security

By: Esther Ayoola Wi oga presido Bola Tinubu like this like this don do two aside tuk with French presido Emmanuel macron about security palava wey  don scarra area for inside the obodo 9ja and how dem fit join hands handle am. The tuk happen on Sunday, as US delegation, including us ambassador to Nigeria, meet national security adviser nuhu ribadu for Abuja to clear the relationship between jaguda boys […]

todayDecember 8, 2025 7

Sports

Egypt FA Push Super Eagles Vs Pharaohs Afcon 2025 Friendly To Dec 16

By: Alice Iduh Egypt football Oga, Khaled El-Darandaly, don share update that  Super Eagles vs Pharaohs friendly no go hold for Sunday again, dem don push am go Tuesday, 16th December for Cairo International Stadium.   Oga Khaled yan tori pipo on Sunday says, dis Na because FIFA, don release new rule, that,  clubs go release players just one week before AFCON.   You sabi say  di AFCON 2025 finals […]

todayDecember 8, 2025 7

National

Vice Presido Shettima Carry Swear Go Swear For New Côte D’ivoire Presido

By: Esther Ayoola Wi Vice Presido, Kashim Shettima don enter Abidjan, Côte d’Ivoire, to stand in for im oga  President Bola Ahmed Tinubu for President Alassane Ouattara fourth-term inauguration wey on shelle today. The update come from Senior Special Assistant to the President on Media and Communications, Stanley Nkwocha. Shettima go join plenty African leaders and international big names take swear for the new presido inside the ceremony wey go […]

todayDecember 8, 2025 7

National

Oluremi Tinubu Yan Marras Dat Nigeria Go Soon Dey Borrow Other Countries Money

By: Alice Iduh First Lady, Senator Oluremi Tinubu, dey show doings,  yanyanpu  say, one day Nigeria go dey  borrow  money to other countries, and that better prosperity dey front.   She yarn this one on Sunday for Ile-Ife, Osun State, after dem give her chieftaincy title, Yeye Asiwaju Gbogbo Ile Oodua.   The event still mark the 10th coronation anniversary of Ooni of Ife, Oba Adeyeye Ogunwusi, wey attract big […]

todayDecember 8, 2025 9

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app