Confederation of African Football, CAF say dem dey find another country to host 2026 Women’s Africa Cup of Nations as dem nor sure whether Morocco wan sti host.
Dem don shift di tournament from March 17–April 3 go July 25–August 16 after dem inform with FIFA and other people wey concern.
Sports News Africa report say Morocco don tell CAF before  say dem no go fit host am for March  because planning problem and other football activities, so like dis CAF dey find new host.