International

174 Results / Page 12 of 20

Background

International

Meta, TikTok Don Gree Obey Australia Under-16 Social Media Ban

Big tech companies like Meta and TikTok don talk say dem go obey Australia new law wey ban pikin under 16 years from using social media, but dem warn say di new law go hard to enforce. From December 10, Australia go force platforms like Facebook, Instagram, and TikTok make dem remove any user wey never reach 16 years old. People around di world dey watch to see if di […]

todayOctober 28, 2025 6

International

Israeli Hostage Families Dey Demand Make Dem Pause Gaza Ceasefire Plan

Di families of Israeli hostages for Monday don demand say di next step for di US-brokered Gaza ceasefire make dem put on hold until Hamas return di remaining bodies of dead captives. Di Hostages and Missing Families Forum talk say, “Hamas sabi exactly where every deceased hostage dey. Two weeks don pass since di deadline wey di agreement set for return of all 48 hostages, but 13 still dey Hamas […]

todayOctober 27, 2025 8

International

Australia Accuse Microsoft Say Dia AI Offer No Pure

Australia competition watchdog don accuse Microsoft say dem mislead people make dem pay for dia AI assistant, Copilot. Di authority talk say dem don file case for Federal Court against Microsoft Australia and dia parent company, Microsoft Corp. Dem claim Microsoft talk “false or misleading” things to about 2.7 million Australians wey dey pay by auto-renew for Microsoft 365 plans wey get online Office services. Microsoft tell people say dem […]

todayOctober 27, 2025 19

International

Ghana Police Free 57 Nigerians From Cybercrime, Trafficking For Accra

Police for Ghana don rescue 57 Nigerians wey dem traffick enter di country come force dem do cybercrime waka. Authorities confirm di mata on Thursday, October 23. Di victims, all between 18 and 26 years, bin dey trapped inside one house for Accra suburb before police raid am on Wednesday. According to di Criminal Investigations Department (CID), di Nigerians bin dey run online romance scam after traffickers deceive dem with […]

todayOctober 24, 2025 19

International

Women Drag Aussie Army For Court Over Sexual Abuse Wahala

Women wey dey inside Australia Defence Force don carry di Australian government go court for massive lawsuit, accuse dem of long-time sexual violence, harassment and discrimination. Di class action wey dem file for Federal Court inside Sydney on Friday, cover abuse wey happen between November 2003 and May 2025. Lawyer Josh Aylward from JGA Saddler talk say for many female soldiers, “di biggest fear no be war, na di sexual […]

todayOctober 24, 2025 12

International

Mosquito Don Show Face For Iceland First Time As Heat Wahala Break Record

For di first time ever, scientists don discover mosquito for Iceland afta record-breaking hot weather wey fit mean say di country fragile environment don dey change. One insect lover, Bjorn Hjaltason, catch two female and one male mosquito wey dem later confirm as Culiseta annulata, one species wey sabi survive winter. Before now, Iceland and Antarctica na di only two places wey no get mosquito because of di cold. Hjaltason […]

todayOctober 24, 2025 29

International

Algeria Oppos Leader Ghares Don Jam Jail For Yabbing President Tebboune

Algerian court don sentence opposition polititian Fethi Ghares to two years jail for Facebook post wey dem talk say insult President Abdelmadjid Tebboune, lawyer talk dis one on Tuesday, October 21. Ghares na well-known secular leftist wey dey criticize government, im lawyer Abdelghani Badi talk say Ghares guilty for “talk wey concern president.” Ghares no dey court when dem give verdict, and defence team dey plan to appeal. Another lawyer […]

todayOctober 22, 2025 11

International

Trump Cancel Putin Meeting, Say Ukraine Wahala Never Calm Down

Di US Presido, Donald Trump don shelve im high-level summit wey dem bin plan with Russian Presido Vladimir Putin, because Moscow no wan gree make ceasefire hold for Ukraine war front. For White House on Tuesday, Trump talk say im no wan waste time for meeting wey no go bring better result. Di two leaders bin dey plan meet for Budapest soon, but di wahala between US and Russia don […]

todayOctober 22, 2025 12

International

Ex-French President Sarkozy Don Land For Jail Over Corrupt Waka

Ex-French president Nicolas Sarkozy don become di first former head of European Union country to enter jail, as dem carry am go La Santé prison for Paris on Tuesday. Sarkozy, wey rule France from 2007 to 2012, don dey face serious wahala since court find am guilty last month say he try collect campaign money from late Libyan dictator Muammar Gaddafi. Even as dem carry am enter prison, di 70-year-old […]

todayOctober 21, 2025 11

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app