International

175 Results / Page 14 of 20

Background

International

Madagascar Military Grab Power After Dem Impeach President Rajoelina

Madagascar wahala don deep pass as di military waka enter power Tuesday afta parliament impeach President Andry Rajoelina. Colonel Michael Randrianirina wey be oga for one elite military unit announce say di armed forces don collect control to “answer di cry of di Malagasy people.” Di Colonel talk dis one for outside di presidential palace, as e declare say dem go scatter di current government wey dey under di 2010 […]

todayOctober 15, 2025 15

International

Madagascar Presido Rajoelina Run As Gen Z Protest Scatter Government

Madagascar Presido, Andry Rajoelina, don jackpa comot di country as Gen Z youths lead heavy protest wey topple di government, opposition leader Siteny Randrianasoloniaiko tell Reuters on Monday. E talk say na on Sunday di man waka, after soldiers join di protesters. “We call di presidency people, dem confirm say he don leave,” Siteny yarn, but nobody sabi where di presido dey now. One military source confam say Rajoelina fly […]

todayOctober 14, 2025 25

International

11-Year-Old Boy Shoot Farm Worker Die

Police for Limpopo don confirm say one 11-year-old boy mistakenly shoot one farm worker die as he dey try shoot guinea fowls for one farm wey dey Thabazimbi. Di incident happen on Saturday when di boy carry im papa gun and e go off, bullet come hit di worker wey dem believe say dey in him 30s. Police spokesperson, Malesela Ledwaba, talk say officers rush come di scene and meet […]

todayOctober 14, 2025 22

International

Hamas Don Start Dey Give Back Israeli Hostages

Hamas don begin to give back Israeli hostages as dem hand over di first seven of di 20 surviving captives to Red Cross people for Gaza on Monday. Dis move bring big joy for Tel Aviv as plenty people gather for support di families wey dem hold hostage. Di handover na part of ceasefire wey US President Donald Trump broker after two years fight, and Hamas suppose release all hostages […]

todayOctober 13, 2025 29

International

At Least 44 People Don Die After Heavy Rain For Mexico

Torrential rain from Tropical Storms Priscilla and Raymond cause big wahala for central and southeastern Mexico October 2025. Di heavy rain make flood and landslide scatter five states like Veracruz, Hidalgo, Puebla, Querétaro, and San Luis Potosí. Government talk say as of October 12, 44 people don die, with Veracruz and Hidalgo carry di worst hit – 18 and 16 deaths respectively. One place for Veracruz catch 21 inches (540 […]

todayOctober 13, 2025 26

International

China Man For Die, But Pig Liver Save Am For 170 Days

Doctors for China don score big win for science as dem report say one 71-year-old man live 171 days after dem transplant gene-edited pig liver give am. Di pig liver stay for him body for 38 days, dey work well as support system, na di first time wey pig-to-human liver transplant go enter peer-reviewed journal. Dem do di surgery for May 2024 for First Affiliated Hospital of Anhui Medical University, […]

todayOctober 10, 2025 52

International

Peru President Don Chop Impeachment After Plenty Scandal Wahala

Peru president, Dina Boluarte, comot from office last Thursday, October 9, after late-night vote for Congress wey different political parties join talk say dem wan carry am go. Boluarte don dey under investigation for months for plenty yawa wey include bribery and how government security forces take kill more than 60 people for protest crackdown wey happen after Pedro Castillo comot from power for 2022. Even though Boluarte deny all […]

todayOctober 10, 2025 26

International

Macron Go Drop New Prime Minister In 48 Hours As France Wahala Choke

French President Emmanuel Macron don announce say e go name new prime minister inside 48 hours as political wahala dey scatter for France. Dis one come after Sebastien Lecornu, wey be France fifth prime minister for just two years, resign on Monday few hours after e show e cabinet. Lecornu, even though e don step down, still dey meet political leaders from both left and right side to try stabilise […]

todayOctober 9, 2025 30

International

Hamas And Israel Agree Say Dem Go Release Hostage And Stop Fight Under Trump Plan

Israel and Hamas don agree for Gaza ceasefire deal to free di remaining living hostages, as big step to end war wey don kill plenty people and cause serious wahala for humanitarian side. Di deal, wey follow 20-point peace plan wey US President Donald Trump announce last month, go make Israel release hundreds of Palestinian prisoners. After more than two years of fight wey start from Hamas attack for October […]

todayOctober 9, 2025 33

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds