NAFDAC don uncover over 20 illegal shops wey dem dey use cook fake drinks for Zamfara Plaza, inside Lagos International Trade Fair Complex, Ojo, on Tuesday, October 13, 2026.
Di agency say dem gbab pipo wey dey mix fake drinks, change expiry date for old drinks to make dem look like fresh one and keep drinks wey dem ban for sale.
NAFDAC say dem gbab two suspects and carry fake drinks and oda items wey worth pass ₦2 billion comot from di place.