International

174 Results / Page 3 of 20

Background

International

Insecurity: Canada Warn Citizens Make Dem No Waka Go Nigeria If No Necessary

Government of Canada don issue fresh travel warning make dia citizens avoid waka go Nigeria if no really necessary, because security wahala full ground for di country. Di warning wey dem update on 24 November talk say Nigeria dey risky because terrorism, crime, inter-communal wahala, armed attacks and kidnapping dey everywhere. Di advisory cover all di country, including Abuja, but Lagos and Calabar dey excepted, even so, travellers suppose dey […]

todayNovember 26, 2025 6

International

Tanzania Cancel Independence Day Celebration Afta Election Wahala

Tanzania don cancel next month independence day celebration, Prime Minister Mwigulu Nchemba don yarn say di money wey suppose dey for di celebration go instead use rebuild infrastructure wey don spoil for di recent election wahala. Di announcement come as opposition and others dey call for people make dem gather on independence day, 9 December, to protest di killings wey happen afta last month disputed election. Opposition talk say hundreds […]

todayNovember 25, 2025 5

International

Ukraine Dey Call Make Trump Meet Zelensky For US Dis Week

Ukraine dey plan make President Zelensky meet Trump for US dis week as peace talks dey continue. Rustem Umerov, head of Ukraine security council, talk say dem don reach “common understanding on di key terms of di agreement” wey dem discuss for Geneva. White House never yarn anything about di Trump-Zelensky meeting yet. Meanwhile, US officials go meet Russian reps for Abu Dhabi. Fighting still dey continue as Russia and […]

todayNovember 25, 2025 5

International

How X New Location Feature Don Expose Big US Politics Accounts

Dozens of big-engagement accounts for X don dey accused say dem dey mislead people after new transparency feature wey dey show user location drop. People for social media notice say some pro-Trump accounts wey dey post about US politics actually dey outside US, and some anti-Trump accounts too dey give wrong location. Some of these accounts don get millions views, likes, reposts and replies wey fit bring dem money from […]

todayNovember 25, 2025 8

International

Malaysia Go Ban Social Media Use For People Wey Never Reach 16 From Next Year

Malaysia don plan to ban anybody wey never reach 16 from opening social media account from next year, as di kontri join other nations wey dey introduce age-limit to protect children from online wahala. Communications Minister Fahmi Fadzil talk dis one on Sunday, and im say government dey study how Australia and other kontries take do dia own regulation. Im yarn say cyberbullying, financial scam and sexual exploitation of minors […]

todayNovember 25, 2025 7

International

I Don Get Sack Unfairly By Paystack – Co-Founder Ezra Olubi

Paystack co-founder and former CTO, Ezra Olubi, don claim say di company sack am unfairly over allegation of sexual misconduct. Di matter burst after one social media post accuse am of abusive behaviour for mid-November, wey cause people dig out old explicit tweets from 2009 to 2013, leading to heavy backlash. Paystack later confirm say dem suspend am and setup independent investigation. But for im blog post titled Terminated, wey […]

todayNovember 24, 2025 8

International

Snapchat Don Begin Age Checks For Australia Ahead Of Di Social Media Ban

Snapchat don begin dey ask teenage Australians make dem verify dia age, di company tok on Monday, just weeks before Canberra go start di new law wey go ban any pikin wey never reach 16 from using social media. From December 10, Australia go force platforms like Facebook, Instagram and TikTok make dem remove users under 16 or face heavy fines. Snapchat say many users go dey asked to verify […]

todayNovember 24, 2025 4

International

Nobody Go Support Am – Ukraine Soldiers React To US Peace Plan

Ukraine frontline soldiers don react to US draft peace proposals with mixture of defiance, anger, and resignation. BBC talk to some soldiers wey send views via social media and email. Yaroslav for eastern Ukraine talk say di plan “sucks… nobody go support am,” while army medic Shtutser call am “absolutely disgraceful draft of peace plan, unworthy of our attention.” But one soldier, Snake, talk say “na time to agree at […]

todayNovember 24, 2025 7

International

U.S Dey Urge Nigerian Government Make Dem Catch Di People Wey Kidnap Schoolgirls

Di United States don call on Nigerian government make dem catch di people wey dey responsible for di recent kidnapping of schoolgirls. Last Monday, November 17, 2025, for Government Girls Comprehensive Secondary School for Maga, Kebbi State, armed bandits carry away no fewer than 25 schoolgirls from dia dormitory. Four days later, di same armed people attack St Mary’s Girls’ School for Papiri, Agwara LGA of Niger State, abducting at […]

todayNovember 24, 2025 5

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app