By: Esther Ayoola
Super Eagles coach, Éric Chelle, don defend why e dey ask Naija Football Federation (NFF) for $130,000 pay raise.
Right now, him dey collect $50,000 per month, however, Chelle dey say di $130,000 no be just for him own pocket, e go also help pay him five-man technical staff, including assistant coach, physical trainer, goalkeeper coach, and personal assistant.
E sti say today players dey need special support staff around dem, so e need correct package to run di team wella.