International

175 Results / Page 6 of 20

Background

International

US Announce New Military Operation To ‘Remove Narco-Terrorists’ For Latin America

US Defense Secretary, Pete Hegseth, don announce on Thursday say dem dey carry out new military operation wey dem call “Operation SOUTHERN SPEAR” to “remove narco-terrorists,” as worry dey grow say US naval buildup for Latin American waters fit mean say dem fit do land strikes and start bigger wahala. Hegseth yan for X say, “Dis mission dey defend our Homeland, remove narco-terrorists from our Hemisphere, and secure our Homeland […]

todayNovember 14, 2025 24

International

Two Nigerian Migrants Don Lost For Deadly Libya Boat Wahala

Two Nigerians dey among dozens of migrants wey dem fear say don die after dia boat capsize for di Central Mediterranean, di International Organisation for Migration (IOM) don confirm. Di waka happun on November 8, when one vessel wey carry 49 migrants and refugees overturn after strong waves make di engine fail, throw all di passengers inside open sea. Di boat bin comot from Zuwara for Libya on November 3 […]

todayNovember 14, 2025 18

International

Europe Dey Prepare For Another War – Russia

Europe dey prepare for another war against Russia as dem dey undermine ongoing peace efforts to settle di Ukraine wahala, na so Foreign Minister Sergey Lavrov talk. For interview wey e give Italian newspaper “Corriere della Sera”, Lavrov drag EU countries say dem dey avoid direct contact with Moscow, dem dey prefer to put “more and more sanctions,” wey be di 19th package wey don dey effective. E talk say, […]

todayNovember 14, 2025 27

International

US Lawmaker Slam Biden For Commot Nigeria From Religious Freedom Watchlist

United States Representative Nancy Mace don slam di former President Joe Biden administration on Thursday, as she talk for her X handle say Nigeria don turn “one of di deadliest countries for Christians.” She vex say Biden remove Nigeria from di US State Department Country of Particular Concern (CPC) list, di list wey dey mark countries wey dey violate religious freedom seriously. Mace compare Biden with Donald Trump, hail Trump […]

todayNovember 14, 2025 24

International

Two Nigerians Don Go Jail For Using Forged Documents Take Get Ghana Card

Two Nigerians, Ike Isaac (wey also bear Alex Kwesi Brown Appiah) and Emmanuel Innocent Egbe (wey also bear Innocent Emmanuel Kodom), don bag 12 months imprisonment each after dem try use forged documents take collect Ghana National Identity Card. Madina District Court II, presided by Her Worship Susana Nyakotey, find di two men guilty of presenting false information and holding forged documents during di Ghana Card registration exercise. Ghana’s National […]

todayNovember 14, 2025 12

International

BBC Don Apologize To Trump Over Documentary Gbege But Dem Reject Im $1bn Wahala

Di BBC don apologize to US President Donald Trump for one edited part for dia Panorama documentary wey make am look like say Trump tell im supporters make dem do violence during dia speech on 6 January 2021. But di corporation don reject Trump demand for $1bn compensation, talk say no be defamation case. Di correction wey BBC release on Thursday evening admit say di clip for Trump: A Second […]

todayNovember 14, 2025 25

International

Libya Don Deport 80 Naija People Over Illegal Stay

Libyan authorities don deport 80 Naija migrants wey dey hold for different detention centres for di country as part of effort to stop irregular migration and reduce overcrowding for di facilities. Di Department for Combating Illegal Migration (DCIM), together with Nigerian Consulate for Tripoli, coordinate di repatriation exercise through Mitiga International Airport on Wednesday. According to Migrant Rescue Watch, wey dey monitor welfare and human rights of migrants for Libya, […]

todayNovember 14, 2025 20

International

Doctors For England Don Start Strike Over Pay And Jobs

Some resident doctors for England wey dey below consultant level, wey be half of di hospital medical workforce, don start strike from 0700 GMT. Di Labour government health minister, Wes Streeting, condemn di action, talk say di doctors’ union, British Medical Association (BMA), dey “choose confrontation over care”. Streeting talk say, “Dis strike no be about fairness again, na political posturing.” E add say, government no fit move on pay, […]

todayNovember 14, 2025 15

International

Two Naija Migrants Dem Fear Say Don Die For Libya Boat Wahala

Two Naija people, wey dey among 42 wey miss for one boat wahala for Mediterranean route, dem don fear say dem don die. Di International Organisation for Migration (IOM) talk for one statement wey dem put for dia website say two oda Naija people survive di wahala. Di incident happen on November 8 when big wave make di boat engine fail, come capsized di boat, throw all di passengers comot […]

todayNovember 14, 2025 15

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds