National

1427 Results / Page 142 of 159

Background

National

Protect Us From Constant Hippo Attack – Gombe Lawmaker Beg FG

Di lawmaker wey dey represent Yamaltu/Deba Federal Constituency for Gombe State, Inuwa Garba, don beg Federal Government make dem help stop di constant hippopotamus attack wey dey kill him people. Garba raise di matter on Thursday as motion of urgent public importance during plenary wey Deputy Speaker Hon Benjamin Kalu preside over. Him talk say di deadly hippo attacks don dey happen regularly for many communities inside di constituency, especially […]

todayOctober 10, 2025 42

National

Police Don Reveal Say Di Suspects Wey Kill Arise News Anchor Carry Their Weapons Come From Niger Republic

Police don talk say di armed robbers wey cause di death of Arise News TV anchor, Somtochukwu Maduagwu, carry dia weapons from arms dealer wey dey Niger Republic. Maduagwu, wey be 29-year-old news anchor, jump from her apartment for Unique Apartments, Katampe Extension, Abuja, on September 29 during robbery attack. Di armed robbers also shoot estate security guard, Barnabas Danlami, kill am for di same incident. On Thursday, police announce […]

todayOctober 10, 2025 40

National

Lagos-Ibadan Expressway Don Turn Nigeria Deadliest Road

Lagos-Ibadan Expressway don become di most dangerous road for Nigeria despite say e good pass many highways. From new FRSC report, 73 people don die and 393 injure for di road between January and March 2025 alone. For di last 27 months, 645 people don lose dia lives and over 3,964 injure for 1,557 accidents wey happen for di 127.6km road wey pass through Lagos, Ogun and Oyo states. Accidents […]

todayOctober 9, 2025 54

National

139 Million Nigerians Don Enter Poverty Level Despite Reforms – World Bank Yarn

World Bank don yan say about 139 million Nigerians dey live for poverty even though government reform don bring more revenue for all levels of government. Matthew Verghis, di World Bank Nigeria country director, talk dis one for Abuja on Wednesday, October 8, during di launch of Nigerian Development Update. E talk say poverty start to rise since 2019 because of wrong policies and wahala like COVID, and e never […]

todayOctober 9, 2025 40

National

Herdsman And 36 Cows Kpai For Plateau

One herdsman, Abubakar Alhaji Woda, don die after unknown gunmen ambush am for Ndinn village, Fan District, Barkin Ladi LGA, Plateau State. Di attack happen on Monday evening as Abubakar dey graze him cattle. Dem shoot am dead and fire gun for him cows too, kill 36 for di spot. Witness dem talk say di attack no get reason and people for di area dey fear as insecurity dey increase […]

todayOctober 9, 2025 27

National

Police Nab Two Guys Wey Dey Feed Bandits Inside Kogi Bush

Security operatives for Yagba West Local Government Area, Kogi State, don catch two men wey dem accuse say dem dey supply food and logistics to bandits wey dey hide for forest. Di suspects na Abayo David and David Bori from Itedo-Ijowa, Isanlu inside Yagba East LGA. Dem nab dem early morning around 4:00 a.m. on Wednesday, October 8, 2025, during patrol by Yagba West Hunters and Vigilante Group. Dem find […]

todayOctober 9, 2025 53

National

Truck Crush Man Die After E Drop Him Pikin For School For Ondo

One man don die gbalaga after one truck crush am for Oda Road, Akure, Ondo State. Di tragic gbege happen early morning on Wednesday, October 8, 2025, as di man dey go back house after e drop him children for school. Tori wey land talk say di truck wey dey speed anyhow lost control, jam di man motorcycle and kill am straight for di spot. One eyewitness wey follow talk […]

todayOctober 9, 2025 35

National

My Resignation No Mean Say I Guilty – Uche Nnaji

Former Minister of Innovation, Science and Technology, Uche Nnaji, talk say e no resign because e do bad thing. E talk say e step down na to protect im name and make sure government reputation no spoil. Nnaji resign on Tuesday, October 7, after gbege burst about im school certificate. University of Nigeria, Nsukka (UNN) talk say dem no give Nnaji any degree certificate because e no finish im school. […]

todayOctober 9, 2025 41

National

FG Dey Beg ASUU Make Dem Comot Di Strike Plan Now.

Federal Government don beg ASUU make dem comot dia planned strike as government dey try settle all di wahala wey ASUU don raise. Minister of Education, Tunji Alausa, talk for Abuja say government don dey work on di union demands and talks between both sides don dey move well. Di Mahmud Yayale Ahmed Federal Government Tertiary Institutions Expanded Negotiation Committee don re-start to make talks quick with all academic and […]

todayOctober 9, 2025 37

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds