By Jolayemi OlajideÂ
As di elder dem take put am dat year “Agboro no dey hide cough,” di fight for justice and di protection of our youths na work wey consain every single one of us for dis country.
Six years after di Lekki Toll Gate shooting, di heavy pain for di mind of parents wey lose dia pikin still fresh like today bread, sake of say “Water wey comot eye no dey ever wash di pain inside belle.”
Even though gormnent scatter SARS come settle some victims with money, we all know say “Money no fit buy life, and e no fit wash hand comot for blood,” since di main officers wey perform di nonsense never chop punishment.
Make nobody think say di mata don die just because area calm, You sabi say “Fowl wey see hawk no dey tok, but e eye dey up,” and Today six years after youths still dey fear di so called police brutality and still all our okporlor eyes dey shine and dey wait for di answers unto wetin really play for di lekki tool gate.
Every October, we burn candle dey write fine grammar, but “Belle no dey hide pregnancy,” as dem empty promises no fit cover di true mata say real police reform never enter sti hapun. ”
If fire hook pesin for body, na to shake am comot first,” so we no fit fold hand make di children wey dey come behind come inherit dis same fear and cheating.
Di heroes wey sacrifice dia life for #EndSARS don run dia own race, and until gormnent step up give people real justice and accountability, “Di ghost of dis mata go continue to hunt di mind of dis country.”
Say No to Police brutality, Say no Oppression!