National

958 Results / Page 91 of 107

Background

National

Gas Scarcity: Price Na Scam, Middlemen Dey Chop Nigerians – NALPGAM

Nigerian Association of Liquefied Petroleum Gas Marketers (NALPGAM) don raise alarm over how cooking gas price don dey jaga-jaga for everywhere for country, say di price wey dey now na fake. National President, Oladapo Olatunbosun yarn dis one for Channels TV The Morning Brief on Wednesday. E talk say di wahala na because PENGASSAN and Dangote Refinery fight, wey cause strike. Di strike make price waka comot from about ₦1,700 […]

todayOctober 8, 2025 20

National

Minister For Innovation, Science And Technology Don Run Comot As Dem Catch Am For Certificate Waka Gbege

Minister for Innovation, Science and Technology, Uche Nnaji, don resign as certificate wahala full ground. Bayo Onanuga, Presidential spokesman, confirm say Nnaji don step down on di night of  October 7. Reports talk say University of Nigeria, Nsukka (UNN) deny say dem ever give Nnaji Bachelor of Science degree certificate because e no finish school. UNN Vice-Chancellor, Simon U. Ortuanya talk say Nnaji come school for 1981 but e no […]

todayOctober 8, 2025 17

National

Yakubu Don Hand Over To Agbamuche As INEC Acting Chairman

Professor Mahmood Yakubu don hand over to May Agbamuche as Acting National Chairman of Independent National Electoral Commission (INEC). Agbamuche na di oldest serving National Commissioner for di electoral body. Yakubu announce dis one Tuesday during ongoing meeting with Resident Electoral Commissioners for INEC headquarters Abuja. E ask di commissioners and directors make dem support Agbamuche till new permanent chairman come. Yakubu dey leave office after completing im two-term 10 […]

todayOctober 8, 2025 9

National

Tinubu Don Spoil Nigeria Economy, But iPhone 17 Don Finish Sell For Naija – Reno Omokri Talk Am Sharp Sharp

Reno Omokri don again drag Nigerians wey dey talk say President Tinubu don finish Nigeria economy. For one Instagram post, Reno yan say some people dey talk say Tinubu don destroy economy, but iPhone 17 Pro Max wey cost $1,999 don sell out finish for Nigeria. E talk say, “Ask those wey buy the phone make dem pay tax, you go hear story. But dem dey expect everything from government […]

todayOctober 8, 2025 19

National

Naija Senate Don Approve 10-Year Passport Ban For Nigerians Wey Dem Convict For Abroad

Naija Senate don push one new bill wey go make dem collect international passport from any Nigerian wey dem convict for crime abroad for at least 10 years. Di bill wey Senator Abubakar Bello from Niger North sponsor wan change di Passport (Miscellaneous Provisions) Act, add strong punishment for Nigerians wey dey do anyhow overseas. Senator Onawo Ogwoshi wey present di bill for Senate floor talk say di move na […]

todayOctober 8, 2025 13

National

Bandits Kidnap Businessman And Him Two Daughters For Niger State

Gunmen wey dem suspect be bandits don invade Zhidi, one community wey dey near Dei‑Dei town for FCT but dey under Tafa LGA, Niger State, abduct business man Muhammad Shuaibu with him two daughters, one na 200‑level student and the other na younger sister. Dem break into the house on Friday, October 2, around 12am, enter through backyard after dem destroy burglar‑proof padlock. Dem even enter the room where wife […]

todayOctober 8, 2025 14

National

Benue Govt Dey Probe Musician Wey Sing Bad Song For Small Pikin

Benue State Bureau for Education Quality Assurance (BEQA) don start investigation after viral video show musician Egyptian Cairo dey perform one song wey get ‘indecent lyrics’ for school pupils. Di song wey dem talk say get vulgar and bad words don cause gbege for public, as parents and community leaders condemn di act, dey call for who organize am make dem answer. Di Director General of BEQA, Dr. Terna Francis, […]

todayOctober 8, 2025 8

National

69-Year-Old Naija Biker Jam 40 Countries In 99 Days To Help Pikin Mental Health

For one heavy show of power and strong mind, 69-year-old Naija adventurer, Ibi Sofekun wey dem dey call Firekiss, don complete him “Ride for the Boy Child” waka, as e cruise 40 countries inside 99 days with him power bike across Europe and Africa. Di journey start from Dublin, Ireland on June 28, 2025, and end for Lagos on Sunday, October 5, 2025, as e ride enter town to hero […]

todayOctober 7, 2025 10

National

Abia Dey Jolly As Tinubu Commission Port Harcourt Road Wey Dem Rebuild

Aba, di commercial city, turn big carnival ground wen President Bola Ahmed Tinubu commission di 6.7km Port Harcourt Road wey Julius Berger Nigeria PLC rebuild. Di place full with better singing and dancing, masquerade display, DJs dey drop better sound. Women and youths no carry last, dem rush come dey celebrate di project like say na redemption. President Tinubu no show face but send Minister of Works, Engr. Dave Umahi. […]

todayOctober 7, 2025 12

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app