By: Esther Ayoola
Dangote Refinery Managing Director, David Bird, say Naija go sti dey get steady fuel supply even as global crude oil price dey hike, like say tomorrow nor dey.
Brent crude oil don nearly reach $120 per barrel based on di wahala for Middle East and plenty geopolitical tension.
Addressing dis mata for press, on Monday, Bird say Dangote go make sure say, di product nor finish even as pipo dey fear say shortage fit hapun because of di war for Iran.