By: Esther Ayoola
Say nor be small gbege for Rivers state, wia African Democratic Congress don call for di arrest and investigation of oga Chairmo of Ikwerre LGA, Wobodo over alleged attack on di convoy of former govo, Rotimi Amaechi.
Nor be amebo say on Friday, March 6, 2026, for di Omuanwa axis, as Amaechi dey travel go him hometown Ubima for party registration say some jaguda boys attack am.
ADC executives make di call when dem dey brief journalists afta di council chairman tuk about wetin happen.
Di chairmo, Leader Bari say di pipo wey do di attack na jaguda boys and not security derefore need to face di laws of di land wella.