National

950 Results / Page 98 of 106

Background

National

FG Don Start Serious Check On Deadly Disease Wey Dey Chop Pipo Flesh For Adamawa

Federal Government don start lab check to sabi wetin dey cause the strange flesh-eating disease wey don kill seven people for Malabu, Adamawa State.Dr. Adesigbin Olufemi, wey be Acting National Coordinator for National Tuberculosis, Buruli Ulcer and Leprosy Control Programme, yarn dis one for interview wey happen for Abuja. Olufemi talk say as at September 10, dem don confirm 67 people wey get di disease, and eight of dem dey […]

todaySeptember 23, 2025 9

National

National Assembly Don Open Natasha Office Again

National Assembly don open back di office of di Senator wey dey represent Kogi Central, Natasha Akpoti-Uduaghan. Her office wey dey Suite 2.05 for Senate Wing, na on Tuesday morning dem open am, and na Sergeant-at-Arms of National Assembly with security pipo help do am. Dem don lock di office since March 6, 2025, wen dem suspend di senator from Red Chamber. For video wey dem share on Tuesday, Deputy […]

todaySeptember 23, 2025 13

National

Motor Dealers Para For Customs Office Say Dem Don Taya For Extortion

Car dealers wey dey under Association of Motor Dealers of Nigeria (AMDON), South-West Zone, come out for protest on Monday for Akure, Ondo State. Dem accuse Nigeria Customs Service (NCS) people say dem dey harass dem, collect money by force, and even seize dia motor anyhow. Di protesters, wey gather for di head office of di Ondo/Ekiti Customs Command, carry placards wey get writings like “We dey pay duty, make […]

todaySeptember 23, 2025 19

National

Senator Natasha Cybercrime Case Jam Gbege, Dem Push Am Go Oct 20

Trial wey dey go against suspended Kogi Central Senator, Natasha Akpoti-Uduaghan, for alleged cybercrime before Justice Mohammed Umar for Federal High Court, Abuja, jam gbege after the defendant raise objection. Akpoti-Uduaghan don face court since June 30 on six-count charge wey Director of Public Prosecution of Federation (DPPF), Mohammed Abubakar, file against her. Dem grant her bail, after dat Justice Mohammed Umar adjourn case till September 22 make trial begin. […]

todaySeptember 22, 2025 11

National

10 People Don Die For Sokoto Boat Gbege

Police for Sokoto don confirm say 10 people die for boat accident for Sabon Birni Local Government Area for di state. Dem talk say di people wey die dey try escape attack wey bandits dey plan for Zalla Bango, one remote village for di council, when di accident happen. Even though national and state emergency people never talk anything about di accident, DSP Ahmed Rufai, Sokoto State Police spokesman, confirm […]

todaySeptember 22, 2025 14

National

FG Don Set Target Say By 2030, 95% Nigerians Go Sabi Digital Work

Federal Government don yan say dem want make 95 percent Nigerians sabi digital work by 2030, with plan to train and empower at least 30 million people by 2027. Director-General of National Information Technology Development Agency, Kashifu Abdullahi, wey Director of Stakeholder Management, Aristotle Onumo, represent, talk dis one for Abuja during Grand Finale of Tech4Dev Digital for All Challenge 2.0. Abdullahi explain say NITDA dey push di plan through […]

todaySeptember 22, 2025 10

National

Tinubu No Get Plan to Stay Pass 2031 – Presidency Reply El-Rufai

Di Special Adviser on Information and Strategy to President Tinubu, Bayo Onanuga, don reply former Kaduna State Governor Nasir El-Rufai, say di talk say President Tinubu wan remain for power pass im tenure na “baseless and absurd.” El-Rufai make di statement during one visit from former Vice President Atiku Abubakar over di weekend, where e accuse Tinubu government say e dey turn to dictatorship, even compare am to Cameroon President […]

todaySeptember 22, 2025 19

National

Supporters Begin Jubilation as Fubara Land for Port Harcourt

Rivers State Governor, Siminalayi Fubara, don land for Port Harcourt Airport today, just two days after President Bola Tinubu lift di State of Emergency wey dem declare for the state on Wednesday evening, October 17, 2025. Governor Fubara, wey come back with him deputy, Prof. Ngozi Odu, and him wife, Valerie Fubara, touch ground for Domestic Wing of Port Harcourt International Airport, Omagwa, around 12:19pm for private jet. As dem […]

todaySeptember 19, 2025 15

National

Senate Beg FCT Doctors Make Dem Stop Strike, Promise Quick Action On Their Demands

Senate Committee for Federal Capital Territory (FCT) Area Councils and Other Matters don beg the striking resident doctors for FCT make dem stop their strike now, talk say dem go waka go meet the FCT Minister, Nyesom Wike, to solve their problem. For emergency meeting wey dem hold on Thursday with the leaders of the FCT chapter of National Association of Resident Doctors (NARD), the committee wey Chairman Senator David […]

todaySeptember 19, 2025 14

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app