obodo oyinbo

580 Results / Page 51 of 65

Background

obodo oyinbo

Mojtaba Khamenei Fit Take Over As Iran Supreme Leader

Say pikin of late Iranian leader Ali Khamenei, Mojtaba Khamenei, dey among di main people wey fit become new oga for Iran. Ahmad Khatami, one member of di Assembly of Experts, na im dey relate di mata to Iranian state media on Wednesday, say dem hope to vote “at di earliest opportunity” to choose di new leader. Other contenders include Alireza Arafi, Mohsen Araki, and Hassan Khomeini, wey fit also […]

todayMarch 5, 2026 31

obodo oyinbo

Iran Drone Hit UK Base For Cyprus, Germany Warn Say NATO Fit Collect Too

Germany foreign minister Johann Wadephul  say attack fit hit NATO country after Iranian drone go hit British air base for Akrotiri, Cyprus. Im tell tori pipo, say, two oda drones sti try attack but dem  intercept dem. According to report, UK don dey do defensive military work for Middle East against Iran to protect dia forces. Wadephul explain to Deutschlandfunk say Germany soldiers fit defend demself, if dem come under […]

todayMarch 3, 2026 36

obodo oyinbo

IMN Protest For Lagos Condemn US, Israel Strike

Members of di South-West leadership of di Islamic Movement for Nigeria don hold peaceful protest for Lagos. Dem dey condemn United States and Israel for killing Iran Supreme Leader, Ayatollah Ali Khamenei. Dem also talk say im wife, Mansoureh Khojasteh Bagherzadeh, sti kpai from wunjuries wey she suffer for di recent attacks for Tehran, say di waka nor make brain at all. Reports talk say Khamenei sef die on Saturday, […]

todayMarch 3, 2026 24

obodo oyinbo

Iran Guards Konfam Missile Attack On Netanyahu Office

Iran Revolutionary Guards don konfamate say dem fire missile to office of Israel Prime Minister Benjamin Netanyahu and headquarters of Israel air force commander. For statement wey Fars news agency carry, dem say na Kheibar missiles na im dem use for the attack. Meanwhile, Iran President Masoud Pezeshkian don appoint Revolutionary Guards General Majid Ebnelreza as acting defense minister. Dis one happen afta im former defense minister die for Israeli-US […]

todayMarch 2, 2026 28

obodo oyinbo

Trump Say Fight With Iran Fit Last Four Weeks

U.S. Presido Donald Trump say di fight with Iran fit last four weeks. E tuk dis one for interview, say di country big, so e go take about four weeks or less. And from report say na three U.S. soldiers don kpai and five get serious wunjury. Trump dey praise im soldiers wey die, call dem “great people and dat, Iran must hear word.

todayMarch 2, 2026 31

obodo oyinbo

Hezbollah Fire Rockets, Drones Enter Israel To Revenge Iran Attack

Hezbollah for Lebanon say dem don fire rocket and send drone to military base for south of Haifa for Israel. Dem say na revenge for Iranian oga Ali Khamenei wey kpai afta U.S. and Israel attack for Tehran. However, Israel tuk say dem don fire back Hezbollah for Lebanon and no go do wahala with dem. Lebanon PM Nawaf Salam say, im ready to protect im pipo to di fullest.

todayMarch 2, 2026 33

obodo oyinbo

Iran Attack Ship For Strait of Hormuz

Global oil price don jump up afta jaguda pipo go attack at least three ship for Strait of Hormuz. UK Maritime Trade Operations Centre (UKMTO) report, na im dey report dis one say, di jaguda boys attack Two ship for Kena. Say dis one sef na based on say Iran dey strike back Middle East aftA  US and Israel bomb Iran. Iran don warn say dem nor go allow any […]

todayMarch 2, 2026 33

obodo oyinbo

Plenti Flight Cancel Afta US-Iran Fire Each other

Flights don scatter everywhere, as thousands of passengers dey stranded as US and Israel attack on Iran make global air travel choke. Countries like Iran, Israel, Qatar, Iraq and UAE lock dia space for air as missile and strike action burst for Gulf region. Airlines from Europe, Asia and America cancel plenti flights as tension for Middle East still dey hot like fire. Iran sharpaly lock dia airspace until further […]

todayMarch 1, 2026 24

obodo oyinbo

Iran Strike Israel and US Base Afta Khamenei Kpai

Iran launch fresh wave of missile and drone attack on Sunday, target 27 US military base for di region and Israel military headquarters for Tel Aviv, say na payback afta big US-Israel strike kill Supreme Leader Ayatollah Ali Khamenei. Iran army for statement wey dem show for state TV talk say dia air force bomb US base for Gulf countries and Kurdistan region of Iraq for different phases of operation. […]

todayMarch 1, 2026 33

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds