By: Esther Ayoola
Israel army commander Lieutenant General Eyal Zamir on Sunday for southern Lebanon announce say Israel don begin big ground operation against Hezbollah because dem wan stop di Iran‑backed group wey dey fire rockets and violate Israel borders.
Oga Zamir say dem don destroy some bridges near di Litani River wey Israel claim Hezbollah dey use cross for attack, and dem plan to advance ground operations and air strikes according to organized plan.
Meanwhile Lebanese President Joseph Aoun condemn di bridge hits and call am dangerous escalation and blatant violation of Lebanon sovereignty, saying na ground war isreal don start like dis.