Sports

807 Results / Page 22 of 90

Background

Sports

Super Eagles To Face Poland, Portugal For Big June Friendlies

Say Nigeria go play Portugal and Poland for big international friendly games for June. Super Eagles, wey just beat Iran 2-1 and draw 2-2 with Jordan for Antalya, Turkey, don dey ready for dis summer programme against European teams. Dem go face Poland for PGE Narodowy Stadium, Warsaw on June 3, before waka go Portugal for second friendly on June 10. Portugal don also konfam say Nigeria go be dia […]

todayApril 3, 2026 18

Sports

NFF Finally Package Election Committee To Run Naija Football

Nigeria Football Federation (NFF) don inaugurate ogbonge Electoral Committee and Electoral Appeals Committee yesterday for their secretariat for Abuja. Dem pick 12 pipo for di two committees, as seven go serve for Electoral Committee while five go handle Electoral Appeals Committee work. Say na NFF president, Ibrahim Gusau, lead di inauguration  dey yarn after dem approve di committees during last week Extraordinary General Assembly say na to stabilize naija football.

todayApril 3, 2026 12

Sports

DR Congo And Nine Oda African Countries Qualify For 2026 World Cup.

Africa don lock record 10 teams for 2026 FIFA World Cup after DR Congo knack di last spot. Di Leopards take di slot after dem hammer Nigeria for African play-offs, then knack Jamaica 1-0 for intercontinental play-offs on Tuesday night. Dem join nine oda African countries wey don already secure dia place. Meanwhile, Super Eagles no fit make am again for second time straight. Na first time Africa go carry […]

todayApril 2, 2026 35

Sports

Super Eagles Hold 26th Spot After Win Over Iran, Draw With Jordan For FIFA Ranking

Nigeria Super Eagles still hold 26th place for di new FIFA World Ranking. FIFA ranking  normally dey follow Elo system wey dey calculate points based on match result, opponent level, and how important di match be. For March friendly matches, dem beat Iran 2-1 and draw Jordan 2-2. Di win against Iran give dem 5.34 points, but di draw with Jordan wey no too strong make dem lose 1.81 points.

todayApril 2, 2026 14

Sports

Victor Boniface Return to Full Training, Fit Play Before Season Finish

By: Esther Ayoola Say Victor Boniface dey happy happy wetin nor good dat im don return back to full fitness afta missing for month sake of wunjury. Di Naija player do knee surgery for January, and people think say e no go play dis season again. But now, Boniface don start training dis week, and e fit even play for Bremen before season finish. Di 25-year-old wey join Green and […]

todayApril 1, 2026 14

Sports

Chelsea Make Premier League Record Loss of £262m

By: Esther Ayoola Say Chelsea don record one kain big loss for Premier League, dat dem loss £262.4 million ($349.3 million) before tax for di last year wey end June 30, 2025. According to experts, say dis record pass di one wey Manchester City get for 2010/11 wey be £197.5 million. Last year, Chelsea bin make profit of £128.4 million because dem sell dia women team to Blueco Midco for […]

todayApril 1, 2026 14

Sports

Kenya Drop $30m, Secure 2027 AFCON Hosting Slot

Kenya don pay $30 million give Confederation of African Football to secure dia place as one of di countries wey go host 2027 AFCON. Minister for Sports, Salim Mvurya, naim share dis update to tori pipo, say dis payment show say Kenya readiness. E sti mention say gornment don set up new Multi-Agency Local Organizing Committee to plan everything.

todayMarch 31, 2026 13

Sports

Ghana Football Association Sack Otto Addo Afta Germany Friendly Loss

Ghana Football Association don sack coach Otto Addo on Tuesday, few hours afta dem lose friendly match 2-1 to Germany for Stuttgart. Na late goal from Deniz Undav make Germany win di match, as e be say Ghana don lose four matches back-to-back, including 5-1 beating from Austria last week. GFA thank Addo for im work but say dem go soon announce new coach as Black Stars dey prepare for […]

todayMarch 31, 2026 21

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds