Sports

Real Madrid Splash €140m To Sign Yan Diomande

todayAugust 7, 2026 9

Background
share close

By: Yusuf Abuh

Real Madrid don complete di signing of 19-year-old Ivory Coast winger Yan Diomande from RB Leipzig for deal wey fit reach €140 million, and di youngster don sign seven-year contract.

Di tin bin dey be like say village pipo dey follow am for back, last last, di transfer, na BBC Sport report on Thursday say Diomande  don become one of di most expensive players wey Real Madrid don ever buy.

Paris Saint-Germain bin dey lead race to sign am before dem comot after RB Leipzig reject dia €120 million bid, while Liverpool own £69 million offer too no work.

Diomande now be di sixth player wey coach Jose Mourinho don sign dis summer as Real Madrid dey prepare for di new season.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds