Sports

533 Results / Page 44 of 60

Background

Sports

Remo Coach Sure Say Dem Go Bounce Back Against Sundowns

Remo Stars coach, Thiago Conde, don talk say di team CAF Champions League journey never finish, even after dem chop 5–1 disgrace for dia home ground in Abeokuta from South African giants Mamelodi Sundowns on Sunday. After di match, Conde admit say him players no follow di game plan well, but still believe say comeback fit still happen for second leg. Him praise di team spirit despite di heavy loss […]

todayOctober 22, 2025 11

Sports

U-17 WW’Cup: Flamingos Wan Take Revenge for France

Nigeria U-17 girls wey dem dey call Flamingos, dey prepare to take revenge against France for dia second Group D match for FIFA U-17 Women’s World Cup wey dey happen for Morocco today (Wednesday). Dem suffer heavy 4–1 loss to Canada for dia first match, and dis one make dem dey bottom of di table with zero points and minus-three goal difference. If dem no fit beat France by 8pm […]

todayOctober 22, 2025 15

Sports

Lopez, Rashford Dey Hot As Barca Thrash Olympiacos 6-1

Fermin Lopez bag hat-trick and Marcus Rashford score two as Barcelona knack Olympiacos 6-1 for Champions League group stage match on Tuesday. Di Catalan giants bin need dis win after dem lose to PSG last time, and dem no waste time bounce back. Teenage baller Lamine Yamal still chop goal as Hansi Flick men, wey dey short of top players like Lewandowski and Raphinha, run riot for Estadi Olímpic Lluis […]

todayOctober 22, 2025 24

Sports

Arsenal Na Kings of Spain, Gunners Smash Record After Dem Wipe Atletico

Arsenal raise plenty eye for Europe after dem hammer Atletico Madrid 4-0 for Emirates Stadium on Tuesday night. But no be only one-off win for Mikel Arteta side, na historic run dem dey make as dem don win seven straight games against Spanish teams for Champions League, something no other team don ever do before. Dem beat Atletico after dem already knack Athletic Club, Real Madrid (home and away), Girona, […]

todayOctober 22, 2025 15

Sports

Nottingham Forest Don Name Sean Dyche As Third Coach 2025-26

Di Aussie coach chop sack just few minutes afta Chelsea knack Forest 3–0 on Saturday afternoon. Di club no waste time as dem sharply bring in Dyche to try rescue di season wey don dey scatter. Postecoglou own short and bitter 39-day stay no produce single win inside eight matches for all competitions. Na serious wahala as di poor results drag Forest go relegation zone and make dia fans vex […]

todayOctober 21, 2025 12

Sports

Postecoglou Comot As Forest Coach After Chelsea Defeat

Nottingham Forest manager Ange Postecoglou don lose him job on Saturday after just eight matches as coach, minutes after Chelsea waka come City Ground carry 3-0 win. Di club put for X say, “After plenty bad results and poor performance, Ange Postecoglou don stop to be head coach immediately.” Di club no want talk more for now. Forest owner Evangelos Marinakis leave him seat during di match, and after full-time, […]

todayOctober 20, 2025 14

Sports

Paz Fire Como Wey Dey Fly High To Historic Win Over Juve

Rising star Nico Paz show big time again for Como as e score one goal and assist one more for Sunday’s important 2-0 win wey dem knack Juventus. Dis win lift di small club go sixth place for Serie A. Paz set up Marc-Oliver Kempf to score quick for di 4th minute for Stadio Giuseppe Sinigaglia, then Paz seal di deal wit one fine solo goal for last 12 minutes. […]

todayOctober 20, 2025 31

Sports

Amorim Want More After ‘Biggest’ Man Utd Win For Liverpool

Ruben Amorim talk say di first win for Anfield since 2016 na correct reward for Manchester United fans wey don suffer long after Harry Maguire late goal make Liverpool lose fourth game in a row. Di 2-1 win give United back-to-back Premier League wins for di first time since Amorim start as coach near one year ago. But di Portuguese coach talk say how di players go perform next weekend […]

todayOctober 20, 2025 12

Sports

Morocco Make History Wit First-Ever FIFA U-20 World Cup Title

For one landmark moment wey sweet African football belle, Morocco knack Argentina 2-0 for di final of di 2025 FIFA U-20 World Cup wey happen early Monday morning for Santiago, Chile. Di North African boys owe dia big win to rising baller Yassir Zabiri, wey tear net two times for first half — one for 12th minute, another for 29th — wey shut di Argentine fans mouth. Even though Argentina […]

todayOctober 20, 2025 31

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app