Sports

808 Results / Page 45 of 90

Background

Sports

AFCON 25: Naija Super Eagles, Egypt Do Jim Jim Di Body For AFCON Round 16

By: Esther Ayoola Africa Cup of Nations Morocco 2025 don dey heat up beta style, say four teams don secure quarter-final spots while Round of 16 still dey go on. Senegal enter first afta dem knack Sudan on Saturday, keep dia unbeaten streak for di tournament alive. Later dat same day, Mali follow join, shock Tunisia for penalties even though dem dey play with 10 men. Now Morocco and Cameroon […]

todayJanuary 5, 2026 19 2

Sports

Coach Chelle Explain Why Im Luck Super Eagles Training

By: Esther Ayoola Super Eagles coachie, Eric Chelle, don come clear im decision to close team training for three days before Nigeria play Mozambique for Africa Cup of Nations 2025 Round of 16. Some Aproko pipo for Morocco bin dey vex say dem nor get access to di super eagles. In fact, Photojournalist Olawale Quadri bin tuk say, rain and catarrh wan bin finish journalists, sake of say dem wan […]

todayJanuary 5, 2026 24

Sports

Cameroon Park South Africa Kaya Comot From AFCON, Beating Dem 2-1

By Ebi Oboko Junior Tchamadeu score first for 34th minute, and Christian Kofane add second goal two minutes after half-time, make Cameroon beat South Africa 2-1 for AFCON last-16. South Africa try fight back as Evidence Makgopa score late, but e no reach. Cameroon don enter  quarter-final, wia dem go face Morocco on Friday. Morocco sef beat Tanzania 1 kondo for dia round of 16 game just before the Cameroon […]

todayJanuary 5, 2026 19 17

Sports

EPL Result: Man City, Chelsea Play Draw Open Way for Arsenal

By Ebi Oboko E be like Arsenal don dey peel out with the EPL title beating Bournemouth 3-2, and with plenty wahala result yesterday. Leeds add salt to Ruben Amorim wunjury and Manchester United, drawing 1 1, Matheus Cunha ni score to save United one point. Everton lose 2 4 to Brentford as Igor Thiago run hat trick, while Beto and Barry score for Everton. Newcastle beat Crystal Palace 2 […]

todayJanuary 5, 2026 29 15

Sports

Mozambique Presido Promise To Give Players Bonus To Beat Super Eagles

By: Rilwan Agbomeji Mozambique Presido, Daniel Francisco Chapo don hail di Mambas afta dem qualify for di Round of 16 for 2025 Africa Cup of Nations wey dey happen for Morocco. E yarn tori pipo on Friday, say, di team show correct football and make di whole country proud, even though dem lose 2-1 to Cameroon for dia last group match. Chapo say di achievement na big one wey nobody […]

todayJanuary 2, 2026 14

Sports

Super Eagles Star Lookman Make CAF Best XI

By: Rilwan Agbomeji Super Eagles forward Ademola Lookman sef make di best players list for group stage of 2025 AFCON, and na di only Nigerian wey dey di team. CAF pick lookman as one of three midfielders alongside Morocco own Brahim Diaz and Cameroon own Carlos Baleba. Lookman score two goals and give two assists for only two matches, including di match-winning goal against Tanzania. Meanwhile, Nigeria coach Eric Chelle […]

todayJanuary 2, 2026 42

Sports

Lawal Wire SMS To Coach Eric Chelle To Tidy Eagles Defence

By: Rilwan Agbomeji Former Naija Midfielder Garba Lawal don advise Super Eagles Coachie, Eric Chelle and im technical crew say make dem sort di defensive issue of di super eafles for round of 16 Nigeria go face Mozambique Mambas on Monday for Fez Stadium to fight for quarter-final spot. Di former midfielder yarn am for on siddon talk show as fans dey ready cheer Nigeria for AFCON. Lawal talk say […]

todayJanuary 2, 2026 19

Sports

Venus Williams Come Back Australian Open At Age 45

By: Rilwan Agbomeji Seven-time Grand Slam champion Venus Williams don get wildcard to play Australian Open at age 45, and tournament organizers talk say she go be di oldest woman wey ever play di competition. She still tuk say Australia give her many good memories and she thankful for di chance to come back to a place wey mean plenty to her tennis career. Officials confirm say Williams go break […]

todayJanuary 2, 2026 12 3

Sports

Tobi Amusan, Naija Athletes Shine for 2025 World Athletics Rankings

By Ebi Oboko Beta start for Tobi Amusan as she begin di new year as one of di top-three for World Athletics ranking for 2025 season. She join two oda Naija athletes – Ezekiel Nathaniel and Chukwuebuka Enekwechi – wey sti dey top 100 for world. Tobi wey be hurdling queen collect silver medal for 100m hurdles for Tokyo 2025 World Athletics Championships. She gather 1,430 ranking points, just dey […]

todayJanuary 2, 2026 17 9

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds