Sports

980 Results / Page 42 of 109

Background

Sports

Kenya Drop $30m, Secure 2027 AFCON Hosting Slot

Kenya don pay $30 million give Confederation of African Football to secure dia place as one of di countries wey go host 2027 AFCON. Minister for Sports, Salim Mvurya, naim share dis update to tori pipo, say dis payment show say Kenya readiness. E sti mention say gornment don set up new Multi-Agency Local Organizing Committee to plan everything.

todayMarch 31, 2026 22

Sports

Ghana Football Association Sack Otto Addo Afta Germany Friendly Loss

Ghana Football Association don sack coach Otto Addo on Tuesday, few hours afta dem lose friendly match 2-1 to Germany for Stuttgart. Na late goal from Deniz Undav make Germany win di match, as e be say Ghana don lose four matches back-to-back, including 5-1 beating from Austria last week. GFA thank Addo for im work but say dem go soon announce new coach as Black Stars dey prepare for […]

todayMarch 31, 2026 34

Sports

Newcastle Stand Fit With Coach Eddie Howe

Newcastle United don clear matas say dem nor dey change dia coachie, Eddie Howe, go remain head coach till end. Rumour bin dey fly say based on Newcastle poor form, say di board wan drive di Howe However, club Chief Executive, David Hopkinson, don clear di mata on Tuesday say, dem nor get any plan to change coach. Hopkinson press tuk say di club dey prepare for summer transfer window, […]

todayMarch 31, 2026 25

Sports

Senegal To Show AFCON Trophy For Home Fans, Snub CAF Decision

Senegal Football Federation tuk say dem go parade dia AFCON 2025 trophy on Tuesday for Abdoulaye Wade Stadium during friendly match against Gambia, as part of pre-match ceremony. Dem yarn dis one for official programme wey dem post, say gate go open 2pm, show start 4pm, and trophy presentation go happen by 5:45pm before kick-off 7pm. According to dem, di move na to celebrate with home fans and show say […]

todayMarch 31, 2026 28

Sports

Germany Beat Ghana 2-1 As Undav Finish Dem Late

By: Esther Ayoola Germany don give Ghana dia second defeat for dis international break beating dem 2-1 with Deniz Undav late goal. Kai Havertz naim score first from penalty give Germany di lead. Ghana, wey lose 5-1 to Austria before, try fight but no fit stop Germany attack. Germany don win seven games straight now, and dem don win three and draw two for five matches against Black Stars now.

todayMarch 31, 2026 18 2

Sports

Quadri Aruna Face Early Exit Afta Pucar Hammer Am 3-0 for ITTF World Cup

By: Esther Ayoola Quadri Aruna dey face wahala for di ITTF World Cup as e lose 3-0 to Tomislav Pucar for him first Group 6 match for Macao on Monday. Pucar carry di win with scores 11-4, 12-10, 11-6 for dia first ever match. Like dis now, Aruna, wey be di only African wey don reach World Cup quarterfinal before, gats beat Sora Matsushima for him next match if e […]

todayMarch 31, 2026 19 2

Sports

Victor Boniface Return Werder Bremen Afta Injury Rehab

By: Esther Ayoola Victor Boniface don return to Werder Bremen afta e finish him rehabilitation for Bayer Leverkusen. According to reports, Di 25-year-old player do surgery for January afta e wunjor for training. Originally, pipo bin dey think say e no go fit play again dis season. But with di latest development e be like, im go sti show workings before di season go end.

todayMarch 31, 2026 31

Sports

Premier League Fans Vote Against VAR Say E Dey Spoil Football

By: Esther Ayoola Say like dis now, Plenty fans wey dey support Premier League clubs dey complain say VAR don spoil dia matchday enjoyment. Dis na according to one survey wey Football Supporters’ Association (FSA) do on Monday across England. Di survey, wey collect response from almost 8,000 fans from all 20 Premier League clubs, show say over 90% of dem believe VAR don make stadium experience worse. Say about […]

todayMarch 30, 2026 26

Sports

Tristan Xerri Chop 3-Match Ban Afta E Rub Nose Blood For Oda Player Face

By: Esther Ayoola North Melbourne player Tristan Xerri don collect three-match ban afta e use im nose blood rub Andy McGrath face for match wey dem play on Saturday. Di incident hapun afta Xerri score goal, come get small fight with McGrath before e wipe di blood, something wey officials call “disgraceful behaviour.” For tribunal, Xerri tuk say dem insult am call am “weak c-word,” naim make e lose im […]

todayMarch 30, 2026 21

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds