Sports

529 Results / Page 53 of 59

Background

Sports

“Di Fixture Schedule No Fair To Man City” – Silva Yarn

Manchester City midfielder Bernardo Silva talk say him team dey for disadvantage against Arsenal because of how Premier League take arrange di fixtures. Gabriel Martinelli score for added time to give Arsenal 1-1 draw for Emirates Stadium on Sunday. City get 66 hours to prepare for di match after dem 2-0 home win against Napoli for Champions League on Thursday. Arsenal win 2-0 against Athletic Club for Bilbao on Tuesday. […]

todaySeptember 22, 2025 20

Sports

Fans Craze As Onana Assist Onuachu

Manchester United goalie wey dey on loan, Andre Onana, make fans go mad with better assist to Naija striker, Paul Onuachu, as Trabzonspor hold Gaziantep 1-1 for Turkish Super Lig match on Saturday. Onuachu score him third goal this season, thanks to Manchester United outcast wey set am up well well with better assist as Trabzonspor bounce back come collect 1-1 draw for di game. Onana first time play for […]

todaySeptember 22, 2025 18

Sports

Ezekiel Nathaniel Break Nigerian 400m Hurdles Record, Dash Finish Fourth For Tokyo Final

Ezekiel Nathaniel make history for Nigeria for Tokyo 2025 World Championships, as e break national record for men 400m hurdles final with hot time of 47.11 seconds to finish fourth.Dem even celebrate Nathaniel small as World Championship bronze medalist after American Rai Benjamin, wey first win, chop disqualification because e waka comot im lane. But after dem appeal, Benjamin result come back as e take be, dem return am to […]

todaySeptember 19, 2025 21

Sports

D’Tigers Don Sharply Drop 11 Places, Land For 53rd Spot For FIBA Rankings

Nigeria men basketball team, D’Tigers, don drop 11 places for di latest FIBA world rankings, dem dey now for 53rd position, afta dem commot for AfroBasket 2025 tournament wey happen for Angola. Di team still fall from number six go number eight for Africa, as dem get 248.7 points now, compared to di 297.8 wey dem get for March 2025 rankings. Di drop put Nigeria among di teams wey fall […]

todaySeptember 19, 2025 21

Sports

FIFA Don Carry Eye Enter Mokoena Matter, South Africa Fit Enter Big Trouble

FIFA don officially open investigation into di eligibility of South Africa midfielder Teboho Mokoena, after report come out say e play for one World Cup qualifying match against Lesotho while e still dey serve suspension, BSNSports.com.ng talk so. Di global football governing body confirm for Thursday say dia Disciplinary Committee dey look into di matter, wey happen during di March 2025 international window. Mokoena dem talk say e no suppose […]

todaySeptember 18, 2025 24

Sports

Super Eagles don fall go 45th for FIFA ranking

Nigeria Super Eagles don fall go 45th for the latest FIFA Men’s World Rankings wey dem release on Thursday, showing say their decline still dey continue after dem draw 1-1 with South Africa for World Cup qualifiers. The Eric Chelle-led team don win 1-0 against Rwanda for their last match but dem no fit keep the momentum for Bloemfontein. The September ranking show say Nigeria don drop one place from […]

todaySeptember 18, 2025 30

Sports

England Striker Harry Kane Use Chelsea Wahala Score Two Goals As Bayern Munich Knack 3-1 For Champions League

Kane, 32, win penalty and score am, then for second half, seal win with fine curled shot after Malo Gusto make mistake. Earlier, Chelsea defender Trevoh Chalobah score own goal, and returning Cole Palmer fire one shot enter top corner to reduce score on him 100th game for all competition for West London team. For second half, warning plenty as Michael Olise and Kane miss correct chances when Chelsea, wey […]

todaySeptember 18, 2025 13

Sports

Liverpool Use Late Drama Take Humble Atletico Madrid As Dem Open Their Champions League Waka For Anfield With Victory.

Alexander Isak finally show face for Liverpool, but e be like say Arne Slot boys go vex as Atletico come back from 2-0 down equal am, until Van Dijk nod better winning goal for stoppage time. No be di new boys, na di old superstar wey show levels, Mohamed Salah run things as Premier League champions tear Atletico 2-0 within six minutes. Salah free-kick bend enter net after e touch […]

todaySeptember 18, 2025 16

Sports

“You No Even Get Mouth” – Lagos Athletes Blast DG Sports Commission Over Team Scatter Matter

Lagos State Government don talk say some athletes beat staff of di commission during protest wey happen on Wednesday, September 17. Di protest happen just few days after Governor Babajide Sanwo-Olu promise to reward di U15 athletes for winning di National Youth Games for Asaba, Delta State. Lagos State Sports Commission don announce say dem don dissolve di Senior Team because of dia act of insubordination. Director General of LSSC, […]

todaySeptember 18, 2025 18

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app