Sports

Celtic Hold Talks With Iheanacho Over New Deal

todayJuly 14, 2026 9

Background
share close

By: Yusuf Abuh

Celtic manager Martin O’Neill don Konfam say di club don make Kelechi Iheanacho offer as talks continue for di striker to return to the team.

Iheanacho contract with di Scottish champions end last month after e join di club last September on one-year deal.

Even though injury affect him and reduce his playing time, di former Manchester City striker still make strong impact with important goals for Celtic.

Di club now dey discuss fresh deal as dem hope to keep Iheanacho for another season.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds