By: Esther Ayoola
China presido, Xi Jinping don declare dat China and India na good neighbours and friends wey suppose to run marras together.
Oga Jinpoing dey uyan dis one, as di two of both of dem dey try fix dia relationship after plenty Trump tariff wahala wey hit dem.
Xi send Republic Day greeting to Indian president Droupadi Murmu, say relationship between both countries don dey get head small small again and e good for world peace and progress.
Dis sweet tuk dey come after almost four years of border tension since 2020 clash wey kill Indian and Chinese soldiers.