By: Yusuf Abuh
At least 39 people naim don die while nine others still dey miss after one serious flood hit Guangxi region for southern China, as rescue and cleanup work still dey go on like dis.
Authorities tok say 26 of di deaths hapun after Liulan Reservoir break, while seven people still dey missing for dat area.
According to report plenty rescue vehicles and security personnel enter Liulan village to support emergency operation and help affected residents.
Heavy rain and severe flooding still dey worry southern and central China, as officials dey prepare for one typhoon wey dey approach eastern parts of di country.